bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Isaiah 29
Isaiah 29
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 28
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 30 →
1
Jerusalem, David town, una own don finish! Make una kontinue to dey do una sakrifice evry year, just as e suppose bi.
2
But mi God go bring wahala kom di town; dem go mourn and kry and e go bi like my altar where dem for dey do sakrifice.
3
I go bi una enemy and I go attack, seize and distroy di town.
4
Jerusalem go fall and as dem dey groun dem go kry for help, but nobody go hear dia vois.
5
Jerusalem, all di strenjas wey attack yu and di sojas wey make yu dey fear, na wons God go blow dem komot like ordinary dust.
6
Den God wey dey lead heaven sojas go send en judgement kom with tonda, eartkweke and one loud vois. E go send strong rain and betta fire follow dem too.
7
E go bi like dream; like vishon for nite. Wahala go dey for all di pipol wey dey fight and disturb God town.
8
E go bi like man wey dey hongry, wey dream sey e dey chop, but wen e wake-up, e si sey en belle still empty. E go bi like man wey dey hongry for wota kon dey dream sey e dey drink, but wen e wake-up, e si sey wota still dey hongry am well-well. Na so e go bi for all di pipol wey dey fight and disturb Mount Zion.
9
Make una kontinue to dey fool unasef! Make una dey bihave like pesin wey nor dey si! Make una dey stagga fall even wen una nor drink wine. Yes! Make una dey stagga waka, even doh una nor drink!
10
God don make una dey do like sey una don drink, so una go sleep go. God don blind di profets eyes and doz wey dey sey future nor go fit si anytin again.
11
To una, evritin wey di profet tok, bi like word wey dem rite for book kon klose am. Wen dem gi-am to pesin wey sabi read kon sey, “Read am,” e go ansa, “I nor fit, bikos dem klose am.”
12
Or if una gi-am to pesin wey nor sabi read make e read am, e nor go fit, bikos e nor sabi read.
13
God sey, “Dis pipol sey dem dey obey mi, dem dey tok good-good tins about mi, but dem nor really dey respet mi and evritin wey dem tok nor rish dia heart. Dia relijon na law and tradishon wey human being make with dia own hand.
14
So I go still do tins wey go dey sopraiz dem: tins wey dem nor go undastand. Wise men nor go get anytin to tok; doz wey get sense nor go fit esplain wetin dey happen.”
15
Pipol wey dey try to hide dia plans from God, nor betta pass doz wey don die! Dem dey hide do dia work for korna, dey tink sey nobody dey si or know wetin dem dey do, bikos dem dey boast sey, “Who dey si us? Who know wetin wi dey do?”
16
Dem dey turn evritin up-side-down. Wish one dey important pass: di pesin wey dey mold di klay or di klay? Wetin pesin make fit ask am, “Na yu make mi?” Abi di pot fit tell who dey make am sey, “Yu know wetin yu dey do so?”
17
So e nor go tey again before Lebanon forest go turn betta groun and di betta groun so for Lebanon, go produce good good food.
18
Wen dat day rish, deaf pipol go hear words wey dem read from book give dem and blind pipol go si even inside darkness.
19
Poor pipol and doz wey honbol diasef go si di happiness wey di Oga wey bi Israel pipol God, dey give.
20
Bikos pipol wey dey opress odas go vanish and all doz wey like to dey do bad tins, go die.
21
God go distroy doz wey dey lie against dia neighbours; pipol wey dey katch and kill pipol and doz wey nor dey give korrect judgement.
22
So Oga God wey diliver Abraham, dis na wetin E dey tell Jakob shidren-shidren: “My pipol, dem nor go disgrace una again and una nor go dey shame again.
23
Wen una go si di shidren wey I go give una, den una go know sey na mi bi Israel God wey dey holy and una go honor my name. Una go honor mi wey bi una King. Yes! Una go respet Israel pipol God.
24
Doz wey dey foolish go undastand well and pipol wey dey always komplain, go get wisdom.”
← Chapter 28
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 53
Chapter 54
Chapter 55
Chapter 56
Chapter 57
Chapter 58
Chapter 59
Chapter 60
Chapter 61
Chapter 62
Chapter 63
Chapter 64
Chapter 65
Chapter 66
Chapter 30 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52
53
54
55
56
57
58
59
60
61
62
63
64
65
66