bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Jeremiah 1
Jeremiah 1
Nigerian Pidgin Bible
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 2 →
1
Jeremaya wey bi Hilkaya pikin, na wetin e profesai, dey dis book. Jeremaya na one among di priests wey dey stay Anatot for Benjamin aria.
2
God first tok to Jeremaya for di thirtint year wen Amon pikin, Josaya dey rule Judah.
3
God still tok to am, wen Josaya pikin, Jehoiakim dey rule for Judah. Afta dat time, God still tok to am until di fift mont for di elevent year wen Zedekaya wey Josaya born, dey rule for Judah and na dat same year, dem katch and karry Jerusalem pipol go Babilon.
4
God tell mi sey,
5
“Before I put yu for yor mama belle, I don know and choose yu. I don selet yu, before dem even born yu. Yes! I don choose yu as my profet and yu go take my message go evriwhere.”
6
So I ansa, “My Oga God, I nor sabi tok well and I still yong too.”
7
But God sey, “Make yu nor sey, ‘I still yong.’ But yu go-go meet anybody wey I send yu go meet kon tell dem evritin wey I kommand yu.
8
Di pipol wey I dey send yu go meet, make yu nor fear dem, bikos I go dey with yu and I go save yu. Mi wey bi God, don tok!”
9
So God stresh en hand kon tosh my mout, den E sey, “Make yu listin, na mi go tell yu wetin yu go tok.
10
So make yu know naw sey, I don give yu pawa ova nashons and kingdoms; to rut and skata; to distroy, ova-take, ribuild and to plant well again.”
11
Afta, God koll and ask mi: “Jeremaya! Wetin yu dey si?” I ansa, “Na one almond tree branch.”
12
Den God sey, “Yu dey rite and dis mean sey, I dey look well to make sure sey evritin go happen, just as I tok am.”
13
God ask mi again, “Na wetin yu dey si?” I ansa, “I si pot wey wota full dey boil for di nort side and e dey kom meet us.”
14
So God tell mi, “Dis mean sey, na from nort I go start to distroy kom and I go distroy evribody wey dey di land.
15
All di sojas for nort, I go soon koll dem kom attack Jerusalem. Dia kings go build dia throne for Jerusalem gate kon distroy all di walls wey dey guide di town. Den dem go attack all di towns for Judah.
16
Like dis, I go ponish my pipol for Jerusalem and Judah, bikos of dia wikedness. Dem forget mi kon dey woship and offa sakrifice give juju and oda gods wey dem make with dia own hand.
17
“But yu, Jeremaya! Make yu ready go tell dem evritin wey I kommand yu. Nor fear dem, if not, I go give yu betta rizin to fear dem.
18
Mi, God don promise to make yu strong like town wey dem dey guide well, wey nobody fit skata and like pila wey dem use iron take make or wall wey get bronze. Yu go fit stand against di whole land: dat is, Judah king, en ofisas, priest and all di pipol for di land.
19
Dem go attack yu, but dem nor go fit win yu, bikos I go dey der to save yu. Mi, wey bi God, don tok.”
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 2 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52