bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Jeremiah 52
Jeremiah 52
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 51
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
1
Zedekaya na twenty-one years wen e start to rule Judah and e rule Jerusalem for eleven years. En mama name na Hamutal and na Jeremaya wey dey stay Libnah town, born am.
2
King Zedekaya sin against God, just as King Jehoiakim do.
3
Bikos God dey vex for Jerusalem and Judah pipol, E kon porshu dem komot for en present go Babilon town. So Zedekaya kon plan against Babilon king
4
and for di tent day for di tent mont for di ninet year wey Zedekaya dey rule, King Nebukadnezzar lead en sojas go fight against Jerusalem. Dem surround di town kon build dia tent near di wall.
5
Dem stay round Jerusalem until di elevent year wey King Zedekaya dey rule.
6
For di ninet day for di fourt mont for dat same year wey Zedekaya don dey rule, di honga for di town kon sirious bikos di food wey remain, don finish.
7
Den dem break one part for di town wall rish groun and all di sojas kon run. Since Babilon pipol surround di town, Zedekaya and en men kon wait make nite rish, before dem pass di gate between di two walls wey dey back of di king gardin kon run dey go Jordan River side.
8
But Babilon sojas porshu King Zedekaya kon katch am for Jeriko road, but en men run leave am.
9
Dem take am go meet Babilon king for Riblah for Hamat land. Den Babilon king judge am for der.
10
E make Zedekaya dey look as dem dey kill en shidren and all en oda ofisas for Judah.
11
Den dem blind Zedekaya eye, tie am with shain kon karry am go Babilon. Zedekaya stay prison till e die.
12
For di tent day for di fift mont for di nineteent year wey King Nebukadnezzar don dey rule, Nebuzaradan wey bi di king advise and dey kommand di sojas, enter Jerusalem.
13
E burn God temple, di royal palis and all di house for Jerusalem. E distroy all di betta-betta house for di town
14
and en sojas kon skata di town wall.
15
Den Nebuzaradan karry di pipol wey remain for di town go Babilon as slave. Di pipol wey remain for di town, na di kraftmen and doz wey ready to serve Babilon king.
16
But e leave some poor pipol for Judah make dem kare for di vineyards and farms.
17
Babilon pipol break di two bronze pilas wey dey God temple front; di bronze wota pot and di big bronze basin, wey dem still dey koll, “Di Sea.” So dem karry all di bronze go Babilon.
18
Dem still karry ash buckets, shovels, lamp, basins, plates and oda bronze tins wey dem dey use take make sakrifice for di temple.
19
Dem take evritin wey dem make with gold and silva: di small basin; di shako pans; di sakrifice blood basin; di ash kontaina, di lampstand, di burnt incense basin and di wine basin.
20
Di two pilas, di Sea with di twelf bronze melu image wey dey under am and di wota pot and wetin dem karry, many well-well. Dem make and put dis tins for God temple wen King Solomon dey rule.
21
“Each of di pila high rish twenty-seven fit kon wide rish eight fit. Dem tick rish three inches and dem get holes.
22
Di bronze on-top each pila high rish seven and half fit and dem dekorate am with pomegranate kon put ornament.
23
Na ninty-six pomegranate fruit dey for each side; di total for evritin na, one hundred pomegranate with di ornament wey dey around di top.”
24
Nebuzaradan wey bi di ofisas oga, take Seraya wey bi di High Priest, Zefanaya wey bi di sekond priest with three shief wey dey keep di gate kon karry dem go as prisonas.
25
From among di pipol wey dey for di town, e take one offisa wey bin dey kare for Jew sojas; seven of di king pesinal advise, di soja kommander, shief seketry and sixty oda pipol.
26
Nebuzaradan, take all of dem go meet Babilon king for Riblah.
27
So Babilon king kill all of dem for Riblah wey dey Hamat land. So dem karry Judah pipol komot from dia own land go Babilon.
28
Di pipol wey Nebukadnezzar karry as prisonas for di sevent year wey e bi king for Babilon, na 3,000 and twenty three.
29
Den for en eighteent year for di throne, e karry eight hundred and thirty-two pipol from Jerusalem.
30
And wen e don rule for twenty-three years, e send Nebuzaradan go karry seven hundred and forty-five pipol kom. So all di pipol wey dem karry as prisonas na, 4,600.
31
For di year wey dem make Evil-Merodak king for Babilon, e sorry for King Jehoiashin for Judah kon release am from prison. Dis tin happen for di twenty-five day for di twelft mont for di thirty-seven year afta dem take Jehoiashin go Babilon as prisona.
32
King Evil-Merodak follow Jehoiashin tok well kon gi-am pozishon wey pass di oda kings wey dem karry kom Babilon as prisonas.
33
So e allow Jehoiashin shange en prison klot, den Jehoiashin kon always dey chop from di king tabol until di day wen e die.
34
Babilon king dey gi-am evritin wey e wont until di day wen e die.
← Chapter 51
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52