bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Jeremiah 4
Jeremiah 4
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 3
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 5 →
1
God sey, “Israel pipol, if una really wont turn back kom meet mi, make una distroy all una juju,
2
den, na only my name una go take swear sey, ‘As long as God dey alive, wi go do wetin wi promise’, den all di nashons go praiz mi and I go bless dem bikos of una.”
3
God tell Judah and Jerusalem pipol sey, “Una too sturbon! Una heart too hard like strong groun wey shuku-shuku full, wey farmer neva dig.
4
Make una keep di kovenant wey una make with mi wey bi una God kon dedikate unasef to mi. If una nor do am and una kontinue di bad tins wey una dey do, my vexnashon go burn una like fire. E go burn well-well and nobody go fit kwensh am.”
5
God sey, “Blow di trumpet for di land! Shaut kon gada evritin togeda! Den tell Judah and Jerusalem pipol sey, make dem run go stay di strong towns.
6
Show dem where dem go pass run go Zion. Make dem run kwik-kwik, so dat dem go dey save! Bikos God dey bring wahala kom from nort and E go distroy well-well.
7
Just like lion wey kom out from where e hide put, na so too di pesin wey dey distroy nashons go kom out. E dey kom distroy Judah: di town go skata finish and nobody go stay der again.”
8
So make una wear sak klot, kry and roll for groun, bikos God still dey vex well-well for Judah.
9
God sey, “For dat day, di mind wey kings get, go fail dem! Priests and profets go dey shek with fear.”
10
Den I sey, “God wey get pawa, wetin make Yu deceive Jerusalem pipol? Yu bin sey peace go dey, but naw, Yu dey ready to kill.
11
“For dat time, dem go tell Jerusalem and Judah pipol sey, “ ‘I dey kommand one strong breeze kom from di desert kom meet my pipol. Di breeze nor bi to blow well or to klean my pipol,
12
and dis breeze go strong well-well! Bikos na only God dey judge en pipol.’
13
Yes, di enemies go kom like kloud. Dia shariot bi like strong breeze and dia horse fast pass eagle.” Den I kon kry, “Wi don die finish o-o, bikos dem go distroy us!”
14
“So Jerusalem pipol, make una from una heart stop all di bad-bad tins wey una dey do, so dat una go dey save. Wetin make una nor fit stop to tink bad-bad tins?
15
From Dan town, one vois dey shaut dey kom and e dey bring bad news kom from Efraim hill.
16
E don kom warn di nashons and tell Jerusalem pipol sey, ‘Wiked sojas dey kom from one far kountry kon tok against Judah town.’
17
Just as pipol dey guide farm, na so di wiked men go surround Jerusalem, bikos en pipol tok against Mi.” God don tok.
18
Judah, na una kause dis wahala, bikos una dey live yeye life kon dey do bad tins. Na una sin kause dis sofa and e go pain una enter una heart.
19
Den I sey, “I nor go fit bear dis pain! My heart dey beat fast-fast! I nor fit kwayet, bikos I hear di trumpets and war nois.
20
I hear as wahala dey happen for evriwhere! Di whole land don skata finish. Yes! Na wons dem distroy awa tent kon tear awa curtains to pieces.
21
Na how long I go dey si awa enemies war flag and hear dia trumpet sound?”
22
But God sey, “My pipol foolish well-well, dem nor know mi at-all. Dem bi shidren wey nor get sense and dem nor dey kwik undastand anytin. Na only bad-bad tins dem sabi do.”
23
I look di eart kon si sey e empty and nor get shape; I look di sky and dia lite kon vanish.
24
As I look di mountins, dem dey shake like man wey dey fear and all di hills dey go back and front.
25
I look kon si sey nobody dey der and di birds for di sky don fly komot.
26
Di land wey dey fruitful before, don empty and evribody dey sofa, bikos of God vexnashon wey dey burn like fire.
27
God sey, “Di whole land go turn desert and I go distroy am finish.
28
Bikos of dis, di eart go kry and di sky go black, bikos God don tok sey na so e go bi and E nor go shange en mind.”
29
Evribody for di land go run wen dem hear di shariot sound kon si sojas with dia bow and arrow. Some go run go hide for forest; odas go klimb mountin go hide for rocks. Di towns go empty and nobody go remain for der again.
30
Jerusalem pipol, naw wey enemies don distroy and porshu una, wetin una go kom do? Aldo una wear red klot and gold kon paint una eye well, but all doz tins nor mean anytin, bikos di pipol wey una love well-well, don rijet and won kill una.
31
I hear kry, like woman wey won born; shaut like woman wey dey born en first pikin. Jerusalem pipol dey find as dem go take breath and naw, dem dey kry sey, “Make una help us! Bikos na die wi dey so o-o!”
← Chapter 3
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 5 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52