bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Jeremiah 28
Jeremiah 28
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 27
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 29 →
1
Dat same year, for di fift mont wey bi di fourt year wey Zedekaya bi king, Hananaya wey bi Azzur pikin, wey bi profet for Gibeon town kon tok to mi for di temple. For di priest and di pipol present, e sey,
2
“Israel God wey dey mighty sey: ‘I don break Babilon king pawa.
3
Before two years go finish, I go bring all di betta-betta tins wey King Nebukadnezzar karry go Babilon kom back to dis place.
4
Jehoiashin wey bi Jehoiakim pikin and all Judah pipol wey go Babilon as slave, I go bring dem kom back. Yes! I go break Babilon king pawa. Mi, wey bi God, don tok.’ ”
5
Den for di priest and all di pipol wey stand for di temple present, I kon tell Hananaya sey:
6
“Amen! Make God make yor profesy, happen! Make E bring all di betta-betta tins wey dem take from en temple and all di pipol wey dem karry go Babilon as slave kom back to dis place.
7
But make yu listin to wetin I dey tell yu and di pipol:
8
‘Before-before, di profet wey tok before mi and yor time, don sey: “War, honga and diziz go kom many nashon and kingdom wey get pawa.” ’
9
But if one profet, profesai peace and good life and e kon happen as e tok, den dat show sey na God really send am.”
10
Hananaya take di wood wey dem tie for my neck komot kon break am to pieces,
11
den e tok for evribody present sey, “God sey dis na how e go take break di load wey King Nebukadnezzar put for di nashons neck and E go do am before two years go finish.” So Profet Jeremaya kon waka go.
12
Afta sometaim, God sey make
13
I go tell Hananaya: “Yu don really break di yoke wey dem make with wood, but naw, na iron yoke yu don put for where e bin dey.
14
Israel God wey dey mighty dey sey, ‘I don put iron yoke for dis nashon and dem go serve King Nebukadnezzar for Babilon. I go even make wild animals serve Babilon king.’ ”
15
Den I tell Hananaya, “Make yu listin to mi! God nor send yu and yu dey make dis pipol bilive yor lie-lie story.
16
So before dis year go end, God go kill yu by ensef, bikos yu don make di pipol dey tok against God.”
17
Just as Jeremaya tok, Hananaya die for di seven mont for dat same year.
← Chapter 27
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 29 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52