bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Jeremiah 38
Jeremiah 38
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 37
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 39 →
1
Shefataya wey bi Mattan pikin; Gedalaya wey Pashhur born; Jehucal wey bi Shelemaya pikin and Pashhur wey Malkijah born kon hear wen I dey tell di pipol sey,
2
“God sey, ‘Anybody wey stay for di town go die for war or honga or diziz go kill-am. But di pipol wey go-go surenda give Babilon pipol, nor go die; dem go eskape with dia life.’ ”
3
Dem still hear wen I sey, “God sey, ‘I go give Babilon sojas dis town and dem go seize am.’ ”
4
Den di ofisas go meet di king kon tell am, “Dis man must die, bikos wetin e dey tok, nor dey help di pipol; e dey kause pain kon make di sojas and evribody for di town, dey fear.”
5
King Zedekaya ansa, “No wahala, make una do am anytin wey una like and I nor go stop una.”
6
So dem tie mi with rope kon drop mi small-small for inside Prince Malkijah well wey dey di palis. Di well dry bikos wota nor dey inside.
7
Ebed Melek, one Ethiopia man wey dey work for di palis, hear sey dem put mi for di well. And by dat time, di king get kase wey e won judge for Benjamin Gate.
8
So Ebed Melek go der go tell di king,
9
“My oga, wetin dis men do so, nor good o-o. Dem don put Jeremaya inside well, where dem know sey honga go kill-am, bikos food nor dey di town.”
10
Den di king sey make Ebed Melek take thirty men follow body, so dat dem go-go bring mi kom out from di well before I go die for der.
11
So Ebed Melek and di men kon go di store where dem dey keep tins for di palis kon kollect old klot, tie am join rope kon trow am give mi.
12
E sey make I put di klot for under my armpit, so dat di rope nor go wound mi. So I do as e tok,
13
den dem drag mi kom out kon take mi go di kourtyard.
14
One day, King Zedekaya sey make dem bring mi kom meet am for di third gate wey dem dey pass enter di temple, den e sey, “I won ask yu kweshon and I wont make yu tell mi di whole trut.”
15
But I ansa, “If I tell yu di trut, yu go kill mi and if I advise yu, yu nor go listin.”
16
So King Zedekaya promise mi for sekret sey, “I swear with God wey dey alive and wey give us life sey, I nor go kill or give yu to di men wey won kill yu.”
17
Den I tell Zedekaya, “Israel God sey, ‘Yu nor go die if yu surenda give Babilon king and dem nor go burn dis town rish groun; both yu and yor family go live.
18
But if yu nor surenda, Babilon pipol go take dis land; dem go burn di town rish groun and yu nor go fit eskape from dem.’ ”
19
But di king ansa, “I dey fear awa own pipol wey don already surenda to Babilon king. Babilon king fit give mi to dem and dem go sofa mi.”
20
So I kon tell am, “E nor go give yu to dem. I dey beg yu make yu listin to God message, den evritin go-go well for yu and dem nor go kill yu.
21
But if yu nor gri surenda, dis na wetin God show mi sey go happen:
22
‘For di vishon, I si sey, dem karry all di wimen wey remain for Judah royal palis go meet Babilon ofisas and dis na wetin dem dey tell di king: “ ‘ “Na yor best friends give yu wrong advise, dem dey kontrol yu and naw wey yu don enter trobol, all of dem don run leave yu.” ’ ”
23
Den I sey, “Dem go take all yor wifes and shidren go give Babilon pipol and yu too nor go fit eskape. Babilon king go katch yu as prisona and dem go burn dis town rish groun.”
24
Zedekaya kon sey, “Nor let anybody know wetin wi tok so, if not yu go die.
25
If di ofisas hear sey I tok to yu, dem go kom ask yu wetin wi tok. Dem go promise yu sey dem nor go kill yu if yu tell dem evritin wey wi tok.
26
But just tell dem sey yu dey beg mi make I nor send yu go back to prison, so dat yu nor go die for der.”
27
So all di ofisas kom kweshon mi and I tell dem wetin di king sey make I tok. Nor-tin dem fit do, bikos anoda pesin nor hear wetin wi tok.
28
So I dey di palis kourtyard, until di day wey dem attack and karry Jerusalem pipol go Babilon.
← Chapter 37
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 39 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52