bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Jeremiah 11
Jeremiah 11
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 10
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 12 →
1
God tell Jeremaya:
2
“Make yu hear di kovenant wey I make with Israel pipol, den go tell Judah and Jerusalem pipol about am.
3
Tell dem sey, ‘Di Oga wey bi Israel God sey, “Curse go follow doz wey nor gri obey di kovenant.”
4
Wen I take Israel, my pipol komot from Egypt where di land bi like fire for dia body, na der I for make kovenant with dem. I tell dem make dem obey and do evritin wey I kommand. I still sey, if dem obey mi, dem go bi my pipol and I go bi dia God.
5
Den I go keep di promise wey I make with dia grand-grand papa kon give dem betta land. And na di land una dey today so.’ ” Den I sey, “Amen! My Oga God, make e bi as Yu tok!”
6
God tell mi, “Make yu go Judah town and Jerusalem street kon tell di pipol sey, ‘Make una listin and obey my kommand!’
7
Bikos, since I take una grand-grand papa komot from Egypt, I warn dem by mysef sey make dem obey mi and naw, I still dey warn una.
8
But dem nor gri listin or obey mi. Instead, dem dey do as dia sturbon and wiked heart tell dem. Na dis make mi curse dem, bikos of my kovenant and dem nor gri do wetin I kommand.”
9
Den God tell mi, “Judah and Jerusalem pipol dey plan against mi.
10
Dem don kontinue di wiked tins wey dia grand-grand papa dem do before, wey make dem nor obey my kommand. Demsef don dey woship oda gods. Both Israel and Judah pipol don break di kovenant wey I make with dia grand-grand papa.
11
So, mi wey bi God sey: ‘I go soon distroy dem and dem nor go fit eskape. I nor go listin to dem wen dem kry kom meet mi for help.’
12
Den, Judah and Jerusalem pipol go kry go meet di gods wey dem dey sakrifice to, so dat dem go kom help dem. But doz gods nor go fit save dem wen di wahala start.
13
Judah pipol gods plenty, just as di towns wey dem get. And as Jerusalem street plenty rish, na so too di altar wey dem build for Baal juju, plenty too.
14
So, Jeremaya my profet! Make yu nor pray or beg mi bikos of dis pipol. Wen dem dey trobol, make dem nor koll mi for help, bikos I nor go listin to dem.”
15
God tell Judah pipol, “Di pipol wey I love dey do wiked tins, so wish rite una get wey make una dey kom my temple? Una tink sey una fit offa sakrifice to stop all di bad tins wey una don do? Una dey happy to do wiked tins even wen una dey offa di sakrifice.
16
I don first koll una olive tree wey get many fine fruit and leaf. But naw, I go kom like tonda kon put fire and e go burn di leaf, den break di branches dem.
17
Mi, God wey dey mighty, na mi kreate una for Israel and Judah and I go bring wahala kom meet una. Yes! Na una kause dis wahala for unasef, bikos una don sin; una make mi vex wen una offa sakrifice give Baal juju.”
18
God give mi sense make I for fit undastand evritin, den E show mi wetin di pipol dey do.
19
Before dis time, I bi like lamb wey dem won go kill, even doh I nor know anytin. I nor know sey na mi dem dey plan dis kind wiked tin for. Dem bin sey, “Make wi kut di tree naw wey e still dey fresh; make wi kill-am, so dat nobody go remember am again.”
20
So I pray to God: “My Oga God wey dey rule all of us; yor judgement na true and Yu dey si wetin pipol dey tink for dia heart. Make Yu fight dis pipol for mi, bikos my life dey yor hand.”
21
Den God tell mi about some men from Anatot wey wont make dem kill mi. Dem don treaten mi sey, “Make yu stop to tok about God, if not, wi go kill yu!”
22
So God wey dey mighty sey, “I go ponish dem! Dem go kill dia yong men for war and na honga go kill dia shidren.
23
I don choose di time wen I go bring dis wahala kom meet Anatot pipol and wen dat time rish, nobody among dem go survive.”
← Chapter 10
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 12 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52