bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Jeremiah 41
Jeremiah 41
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 40
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 42 →
1
For di sevent mont for dat same year, Ishmael wey Elishama pikin, Netanaya born, wey still bi memba for di royal family and one of di king main offisa kon go meet Gedalaya for Mizpa and e karry ten men follow body. Wen all of dem dey chop togeda,
2
Ishmael and di ten men, bring dia swod out kon kill Gedalaya wey Babilon king put as govnor for Judah.
3
Ishmael still kill Israel pipol and Babilon sojas wey follow Gedalaya dey for Mizpa.
4
Di next day, before anybody know sey Gedalaya don die,
5
eight men kom from Shekem, Shiloh and Samaria. Dem don skrape dia hair, tear dia klot kon kut demsef to show sey dem dey mourn and dem karry korn and incense go offa for di temple.
6
So Ishmael kry komot for Mizpa go meet dem. Wen e si dem, e kon sey, “Abeg! Make una kom si wetin happen to Gedalaya!”
7
But as dem just enter di town, Ishmael and en men kill dem kon trow dia body put for well.
8
But e get ten men for di group wey tell Ishmael sey, “Abeg! Make yu nor kill us! Wi get wheat, barley, olive oil and honey wey wi hide for farm.” So e nor kill doz ones.
9
Di well wey Ishmael trow di men dead body put, na King Asa dig am wen King Baasha for Israel kom attack am. Naw, Ishmael don pak dead body full am.
10
Den di king dota and all di rest pipol for Mizpa wey Nebuzaradan put for Gedalaya kare, Ishmael kon karry all of dem go Ammon land as prisonas.
11
But wen Johanan and di oda soja leaders hear wetin Ishmael do,
12
dem kon porshu and katch Ishmael near di big pool wey dey Gibeon.
13
Wen di pipol wey Ishmael katch as prisonas si Johanan and di oda sojas, dem kon dey happy.
14
Dem turn kon run go meet Johanan, so dat e go help dem.
15
But Ishmael and eight of en men run leave Johanan kon eskape go Ammon land.
16
Den Johanan and di oda sojas oga karry all di pipol wey Ishmael katch as prisonas from Mizpa, afta e don kill Gedalaya.
17
Dem take all of dem go Gerut Kimham village near Betlehem and dem from der go Egypt.
18
Dem dey fear wetin Babilon pipol go do wen dem hear sey Ishmael kill Gedalaya, di govnor wey Babilon king choose. As dem dey go, dem kon stop for Kimham wey dey near Betlehem.
← Chapter 40
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 51
Chapter 52
Chapter 42 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
51
52