bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 1
Ezekiel 1
Nigerian Pidgin Bible
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 2 →
1
Thirty years afta dem karry us go Babilon as slave, wen I dey stay with my pipol near Chebar River, for di fift day for di fourt mont, heaven open and I kon si one vishon.
2
(Dis tin happen for di fift day for di mont wey bi di fift year wey King Jehoiashin bi prisona for Babilon.
3
Na God give dis message to mi Ezekiel Buzi pikin, wey bi priest, near Chebar River for Babilon and I feel en hand for my body.)
4
As I dey look, I si strong breeze dey blow kom from nort and tick kloud with tonda lite dey round am. Fire still dey der too and I si one tin dey shine inside di fire.
5
I still si four creatures wey dey alive inside di fire and dem bi like human being.
6
But each of dem get four face and four feadas.
7
Dia legs strait well-well, but dia toe bi like melu own and e dey shine like bronze wey dem polish.
8
Under dia feadas for di four side, dem get human being hand. All of dem get four face and four feadas
9
and dia feadas dey tosh each oda. Each one dey waka go strait and dem nor dey turn as dem dey waka.
10
Dis na how dia face bi like: Human being face for front, lion face for di rite side, melu face for di left side and eagle face for back.
11
Each of dem get two-two feadas wey dey tosh di oda creature feadas and di oda two feadas dey kover dia body.
12
Each of di creature face di four direcshon, so wen dia spirit won waka go anywhere, dem dey waka without sey dem turn.
13
Among di creatures, e get sometin wey bi like tosh or tick fire and e just dey move. Di fire dey move from front go back, e dey shine well-well and dey bring out tonda lite.
14
Di creatures dey waka go front and back kwik-kwik like tonda lite.
15
As I dey look di creatures, I kon si four wheel for di eart and one dey near each of dem.
16
All di four wheel bi like jasper and each one dey shine like gold and dem build dem like sey one wheel dey inside anoda one.
17
Wen dem dey move, dem fit go any of di four direcshon wey dem face and dem nor dey turn as dem dey move.
18
Eyes full di rims wey dey di four wheel and dem high well-well kon make pipol dey fear.
19
Wen di creatures dey move, di wheels dey move too. Wen di creatures raiz-up komot groun, di wheel go-go up too.
20
Anywhere di spirit won go, dem go-go too and di wheel go follow dem, bikos di creatures spirit dey inside di wheel.
21
Wen di creatures move, di wheels go move too and wen dem stop to waka, di wheels go stop. Wen dem raiz komot groun, di wheels go raiz too, bikos dia spirit dey inside di wheels.
22
Sometin wey flat wey dem make with crystal glass, dey on-top di creatures head.
23
Under di flat crystal glass, dia feadas stresh kom out kon face each oda. Two feadas kover outside, while two dey kover dia body.
24
Wen dem dey waka, I dey hear dia feadas sound. Di sound bi like God vois or wota wey dey rush pass with pawa or like sojas wey gada dey go war. Wen dem stop to waka, dem kon bring dia feadas down.
25
Den, one vois kon tok from di flat crystal wey dey on-top dem.
26
On-top di flat crystal wey dey dia head, e get one tin wey bi like throne wey dem make with safaya. On-top di throne, wetin dey der, bi like human being.
27
I si sometin wey bi like fire wey dey burn from en waist go up. And from en waist kom down, I still si sometin wey bi like fire wey dey burn and di lite wey dey round am, dey shine well-well.
28
Di lite wey dey shine round am bi like rainbow afta rain don fall. Dis na di lite wey dey show how God glory bi. Wen I si am, I fall face groun and I kon hear somebody dey tok.
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 2 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48