bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 14
Ezekiel 14
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 13
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 15 →
1
Some leaders for Israel kom meet and ask mi sey, “Wetin God wont?”
2
So God tell mi:
3
“Man pikin, dis pipol don give dia heart to juju and na di juju dey make dem sin. Dem tink sey I go ansa dem?
4
Naw, go tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell dem: Israel pipol dey serve juju and dis juju don make dem dey sin; so if dem go ask any profet kweshon, na mi God go give dem di kind ansa wey good for dia many juju!
5
All dis juju don make Israel pipol turn from mi, but afta I don ansa dem, I bilive sey dem go turn back kom meet mi.
6
“Naw, make yu tell Israel pipol wetin mi God wey get pawa dey tok: Make una turn back from una juju and from di yeye life wey una dey live.
7
Wen ever any Israel pesin or strenja for Israel turn leave mi kon go serve juju, den e go ask profet kweshon, na mi wey bi God, go ansa am!
8
I go oppoz am. I go use am make ezample for odas. I go komot am from among my pipol. Den una go know sey na mi bi God.
9
“If any profet give una wrong massage, make una know sey na mi wey bi God do am like dat. But I go still rijet and remove am from among my pipol for Israel.
10
Both di profet and di pipol wey ask am kweshon, na di same ponishment I go give dem too.
11
I go do like dis, so dat Israel pipol go obey and dem nor go turn from mi. Dem suppose bi my pipol and I go bi dia God.” God wey get pawa don tok.
12
Den, God kon tell mi:
13
“Man pikin, if one kountry sin kon disobey mi, I go stop to give dem food chop. I go send betta honga go der kon kill both animal and human being.
14
Even if Noah, Daniel and Job dey stay der, dia good wey dem dey do, go save only dia own life.” God wey get pawa don tok.
15
“Or I fit send wiked animal make e kom kill di pipol, den evribody go dey fear di land; nobody go fit travel pass am
16
and even if Noah, Daniel and Job dey stay der, as long as mi wey bi God wey get pawa dey alive, dem nor go even fit save dia own shidren. Dem go save only dia life and di land go bi like wildaness.
17
“Or I fit send war kom dat kountry and dem go distroy di pipol and dia animals with gun, swods and knife
18
and even if doz three men dey stay der, as long as mi wey bi God wey get pawa dey alive, dem nor go even fit save dia own shidren, na only dia own life dem go save.
19
“If I send betta diziz go dat kountry kon kill many pipol and animals, bikos I dey vex
20
even if Noah, Daniel and Job dey stay der, as long as mi wey bi God wey get pawa dey alive, dem nor go even fit save dia own shidren, di betta tins wey dem do, go only save dia own life.”
21
Dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I go send my four worse ponishment kom Jerusalem and dem bi: war, honga, wiked animals and diziz. I go send dem kon distroy di pipol and dia animals.
22
Yet some pipol go survive for di town, both sons and dotas and dem go karry dem as prisonas go Babilon and wen yu si as dem sin rish, yu go know why I do all dis tins.
23
Yu go si di real rizin why I dey do wetin I dey do.” God wey get pawa don tok.
← Chapter 13
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 15 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48