bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 17
Ezekiel 17
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 18 →
1
God kon tell mi:
2
“Man pikin, go tell Israel pipol dis parabol;
3
tell dem sey di Oga God wey get pawa well-well sey: “One big eagle wey get fine and long feadas, fly go Mount Lebanon kon break di branches wey high pass for one cedar tree komot,
4
den e karry am go where pipol for dey do business kon plant am for der.
5
E take one small plant for Israel kon go plant am for betta groun and wota dey always dey di place so dat e go grow.
6
So di plant grow kon spread for evriwhere like grape tree. Di branches dem grow well-well and en rut strong for groun too. E kon turn to big vine tree wey get many branches and leaf.
7
Anoda strong eagle wey get big and tick feada dey. Naw, di rut and leaf for di vine face dis eagle, bikos di vine bilive sey di eagle go gi-am more wota pass di one wey di gardin dey give,
8
even doh dem don already plant di vine for betta groun wey get wota, wey go make am grow well kon bear betta and sweet fruits.
9
Naw, mi God wey get pawa dey ask: Dis vine go prosper? No! I go plok all en fruit kon rut am komot groun and en leaf go dry kon die. I nor nid strong hand or many pipol, bikos e nor go hard mi to rut am from groun.
10
Yes, dem don plant am, but e go fit prosper? E nor go die wen breeze blow kom from east? Abi e nor go dry finish for where e for dey grow?”
11
God tell mi,
12
“Ask dis bad pipol if dem know wetin di parabol mean. Tell dem sey Babilon king kom katch and karry Jerusalem king and en ofisas go Babilon.
13
E choose one of Jerusalem king broda, enter agriment with am kon make am swear sey e go always dey loyal to am. E katch and karry important pipol go prison,
14
so dat Jerusalem nor go raiz again and to make sure sey dem go keep di agriment wey dem make with am.
15
But Judah king go against Babilon king. E go hire horse and many sojas from Egypt. Naw, with all dis one, e go fit win di fight against Babilon king? E go fit do wetin e plan? E go fit break di agriment and nobody go ponish am?
16
“As long as I bi God wey nor dey die, dis king go die for Babilon, bikos e break di agriment wey e make with Babilon king wey put am for di throne.
17
Wen Babilon sojas don ready to attack and kill pipol, even di sojas wey strong pass for Egypt nor go fit help Judah king, tok-less of to save am,
18
bikos e don break di agriment wey e make. E do all dis tins and naw, e nor go eskape am.”
19
So God wey get pawa sey, “As long as I bi di God wey nor dey die, I go ponish am, bikos e break di agriment wey e make with my name.
20
I go katch am with my net. I go take am go Babilon kon ponish am for der, bikos e disobey mi.
21
Dem go kill en betta-betta sojas for war and di ones wey survive go skata for evriwhere. Den e go know sey, Mi, wey bi God, don tok.”
22
Dis na wetin God dey tok: “I go kut di branches wey high pass for di cedar tree komot, den I go plant am on-top mountin
23
and na on-top di mountin wey high pass for Israel. E go grow kon get branches; bear seed and e go bi very fine cedar. Difren birds go stay der kon build house put for di cedar tree.
24
Evry tree for di land go know sey na mi bi God. I go kut di trees wey tall and di ones wey short, I go make dem tall. I go make green trees dry kon make dry trees, green. Mi wey bi God don tok and I go do wetin I sey I go do.”
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 18 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48