bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 19
Ezekiel 19
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 18
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 20 →
1
God sey make I sing dis sorrowful song for di prince dem wey dey Israel:
2
“Una mama na really strong lion wey train en shidren for where oda wiked lions dey.
3
E tish one among en shidren how e go take katch oda animals and naw, e dey chop human being.
4
But pipol for oda nashons hear about am, so dem tie and trow am inside pit kon drag am with hook go Egypt.
5
Wen di mama wait kon si sey en pikin nor dey kom back again, e kon train anoda lion wey wiked pass di first one.
6
Wen dat one don big, e kon start to katch animals and chop human being like oda lions.
7
E skata where sojas dey guide well and distroy dia towns. Di way e dey shaut, dey make di pipol for di land dey fear.
8
Pipol gada kom from evriwhere kon fight am. Dem spread dia net kon katch am with dia trap.
9
Den dem put am for kage kon karry am go give Babilon king. Dem put am for prison, so dat pipol nor go hear en vois again on-top Israel mountin.
10
Yor mama bi like vine wey dem plant near wota wey get fresh leaf and dey bear good fruits.
11
En branches strong well-well like royal rod. Di vine grow and tall well-well. Yes! Evribody si as e tall rish and how en leaf fine.
12
But wiked pipol kon kut am down. Di wind blow kon dry all en fruit. En branches dem break komot kon dry and fire burn dem.
13
Naw, dem plant am for desert; di place wey dry and nor get wota.
14
Den fire katch di vine kon burn evritin plus en fruit finish and e nor go ever strong again. E nor go ever bi dat royal rod again. “Dis na di sorrowful song wey dem go always dey sing.”
← Chapter 18
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 20 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48