bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 37
Ezekiel 37
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 36
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 38 →
1
Den God pawa enter my body and en spirit kon karry mi go one valley where dry bones full.
2
E take mi waka round di place and I kon si sey di bones many and dem dry well-well.
3
E kon tell mi, “Man pikin, yu bilive sey dis bones fit turn to human being again?” I kon ansa, “God wey get pawa, na only Yu fit ansa dat kind kweshon!”
4
E kon sey, “Tok to di bones. Tell di bones sey make dem listin to wetin God dey tok.
5
Make yu tell dem wetin mi God wey get pawa dey tell dem: I go give una life again.
6
I go give una flesh kon kover una body with skin. I go bring una kom back to life. Den una go know sey na mi bi God.”
7
So I tok to di bones just as God tell mi. As I dey tok, I hear one strong nois and di bones kon dey join togeda.
8
As I dey look, flesh kon kover di bones, den dem kon get skin. But dia body nor get life.
9
God kon tell mi, “Man pikin, tok to di breeze. Tell di breeze sey God wey get pawa dey kommand am to kom from difren place kon give life to dis body dem wey dey groun, so dat dem go get life.”
10
So I kon tok as God don tell mi. Life kon enter di body dem and dem kon stand up. Dem many well-well like sojas.
11
God kon tell mi, “Man pikin, Israel pipol bi like dis bones. Dem sey dem don dry finish, dem nor get hope or bilive sey dia future dey brite.
12
So, go tell Israel pipol sey mi wey bi dia Oga God go open dia graves kon take dia dead body kom out; give dem life, den bring dem kom back to Israel land.
13
Wen I open di grave where dem beri my pipol put kon bring dem out, na den dem go know sey na mi bi God.
14
I go give dem my own Spirit kon make dem stay for dia own land. Den, dem go know sey na mi bi God. I don promise sey I go do wetin I tok and I go do am. Mi, wey bi God, don tok.”
15
God kon tell mi again:
16
“Man pikin, take one stik make yu rite dis word put, ‘Judah kingdom.’ Den take anoda stik kon rite dis word put too, ‘Israel kingdom.’
17
Den hold di two for hand, so dat dem go look like one stik.
18
Wen yor pipol ask yu sey make yu tell dem wetin dis tin mean,
19
tell dem sey, ‘God wey get pawa go take di stik wey dem rite Israel put kon join am with di one wey dem rite Judah put. E go use di two make one stik kon hold am for en hand.’
20
So, make yu hold di two stik for yor hand, so dat di pipol go si dem.
21
Den make yu tell dem sey, ‘God wey get pawa go-go bring all en pipol for evriwhere wey dem skata go. E go bring dem kom back to dia own land.
22
For di land wey dey Israel mountin, God go turn all of dem to one nashon. Dem go get one king wey go rule dem and dem nor go skata again.
23
Dem nor go spoil dia body with juju or anytin wey go make dem dirty or sin again. God go free dem from evritin wey dey make dem sin. E go klean dem; dem go bi en pipol and E go bi dia God.’
24
“Na from my savant David house, dia king go from kom. All of dem go dey happy under one king and dem go obey and respet all my laws.
25
Dem go stay for di land wey I give Jakob wey bi my savant; di land where dia grand-grand papa dey before. Dem with dia shidren and grand-shidren go stay der forever. Na from my savant David house, dia king go always kom from.
26
I go make kovenant with dem wey go make dem dey save forever. I go make dem prosper and dem go many well-well. I go make sure sey my temple dey for dia land forever.
27
I go stay der with dem; I go bi dia God and dem go bi my pipol.
28
Wen I don build my temple for dia land forever, den di oda nashons go know sey, mi God don choose Israel as my own pipol.”
← Chapter 36
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 38 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48