bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 10
Ezekiel 10
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 9
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 11 →
1
I look on-top di creatures wey dey alive kon si sometin wey bi like throne wey dem make with safaya.
2
So God tell di man wey wear linen sey, “Go under di wheel make yu pak shako full hand kon go pour am for di town.” So, I look am as e dey go.
3
As di man go inside, di creatures stand face di sout-side for di temple and kloud kon full inside di kourtyard.
4
God glory kon raiz-up from di creatures and E move go di temple gate. Den kloud full di temple and di kourt kon dey shine, bikos of di lite.
5
Pipol wey dey outside di kourtyard dey hear di nois wey di creatures feada dey make and e bi like sey na Oga God dey tok.
6
Wen God sey make di man wey wear linen go take fire from under di wheel, di man go inside go stand near one of di wheel.
7
One among di creatures kon put en hand inside di fire, pak some shako, den e put am for di man hand. Di man take di shako kon komot der.
8
I si sey di creatures get sometin wey bi like human being hand under dia feada.
9
I still si sey dem get four wheel wey bi like each oda and each wheel dey near en creature.
10
And wen I look dem well: di four wheel resemble each oda like sey dem get wheel inside dia wheel.
11
Di creatures fit go anywhere without sey dem turn. Dem dey go di direcshon wey dem like without sey dem turn.
12
Eyes dey evriwhere for dia body, back, hand, feada and wheel.
13
I hear as dem dey koll dia wheel, “O wheel.”
14
Each creature get four face. Di first one face na, angel own, di sekond one, na human being own, di third one, na lion own and di fourt one, na eagle own.
15
(Dem bi di same creature wey I si for Chebar River.) Wen di creature get up
16
kon move, di wheel follow dem. Even wen dem won fly, di wheel dey follow dem fly too.
17
Wen dem stop, di wheel stop too and wen di creature fly again, di wheel follow dem, bikos na di creatures dey kontrol di wheel.
18
Den God glory komot from di temple gate kon go where high pass where di creatures dey.
19
Dem spread dia feada kon fly komot di eart and I dey look as di wheel follow dem. Dem stop for di east gate for di temple and Israel God glory kon kover dem.
20
I si dem as di same creatures wey I bin si under Israel God for Chebar River. I know sey dem bi angel.
21
Each of dem get four face, four feada and sometin wey bi like human being hand, dey under dia feada.
22
Dia face just bi like di face wey I si for Chebar River. Each creature just dey waka strait dey go.
← Chapter 9
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 11 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48