bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 32
Ezekiel 32
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 31
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 33 →
1
Twelf years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di first day for di twelft mont, God kon tell mi.
2
“Man pikin, go warn Egypt king. Tell am dis message wey I dey give yu: “ ‘Yu bi lion among di nashons, but na ordinary animal yu bi for sea; Yu dey skata di wota with yor leg kon make di river dirty.
3
Wen many kountries gada, na der I go for katch yu with my net kon drag yu kom dry land.
4
I go trow yu for groun make all di birds and animals for di world chop yu finish.
5
I go spread yor rotin flesh for di mountins and valleys.
6
I go pour yor blood from groun go rish on-top di mountin and blood go full di valley.
7
Wen I don distroy yu, I go kover di sky kon komot di stars. Di sun go hide for di kloud back and di moon nor go shine again.
8
I go off all di lite for heaven kon kover di world with darkness.’ ” Mi, God wey get pawa, don tok.
9
“Di kountries wey yu neva hear of before, wen I tell dem how I take distroy yu, fear go katch dem.
10
Wetin I do yu go make many kountries dey fear and dia kings go dey shake with fear bikos of yor kondishon. For di day wey yu go fall, all of dem go dey fear for dia own life.”
11
God wey get pawa kon tell Egypt king sey, “Babilon king go kom fight yu.
12
“I go let sojas from kountries wey get pawa, kill yor men for war. Dem go distroy all yor pipol and evritin wey dey make yu karry body up.
13
I go distroy all yor animals near where wota dey and nobody or animals go disturb di wota again.
14
Den I go make di wota kwayet again kon make di sea flow like oil.” Mi, God wey get pawa, don tok.
15
“Wen I don make Egypt land empty and distroy evritin wey dey der, den una go know sey na mi bi God.
16
Dis warnin wey I dey give dem naw so, go turn to sorrowful song Leta. Di wimen go sing di song as dem dey mourn for Egypt and en pipol.” Mi, God wey get pawa, don tok.
17
For di Fifteent day for di first mont for di twelft year, God kon tell mi:
18
“Man pikin, kry for Egypt pipol. Send dem with di oda kountries wey get pawa go where dead body dey.
19
Tell dem sey, ‘Who una tink sey una fine pass? Una go-go where dead body dey kon follow wiked pipol stay der.’
20
Egypt pipol go fall with doz wey die for war. Yes! One swod dey ready to kill all of dem.
21
Pipol wey dey strong for dis life before dem die and doz wey fight for Egypt before, go welkom Egypt pipol wen dem kom where dead body dey. Dem go shaut: ‘Wiked pipol wey dem kill for war don kom relax for here!’
22
“Assyria pipol dey der with all en sojas grave. All of dem die for war
23
and dia grave dey for where deep pass. All Assyria sojas die for war and dia grave dey round en grave. But before wen dem dey alive, dem dey make pipol fear.
24
“Elam dey der and all en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die go where dead body. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.
25
Among doz wey don die, dem make somewhere for Elam and en pipol. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.
26
“Meshak and Tubal dey der too and en sojas grave dey round am. Dem kill all of dem for war and dem neva sekonsaiz dem before dem die. Wen dem dey alive, dem dey make wahala, but naw, all of dem don die with shame.
27
Dem nor beri dem as dem bin dey beri pipol wey really fight and die for dia kountries; pipol wey dem beri with dia swod under dia head and dia shield for dia body. Dis pipol dey make pipol fear wen dem dey alive.
28
“But naw, dem go win una and una go die go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.
29
“Edom dey der with en kings and rulers. Dem bi sojas wey get pawa, but naw, dem don die kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.
30
“All di prince for nort plus Sidon pipol dey der too. Even with all di pawa wey dey make pipol fear before, dem still die with shame kon go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.”
31
God wey get pawa sey, “Wen Egypt king and en sojas go si doz wey dem kill for war, belle go sweet dem small.
32
Aldo, na mi worry Egypt king wen e dey alive, so en and en sojas go die go join doz dead body wey dem nor sekonsaiz.” God wey get pawa don tok.
← Chapter 31
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 33 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48