bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 3
Ezekiel 3
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 2
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 4 →
1
God sey, “Man pikin, make yu chop dis book; den go tok to Israel pipol.”
2
So I open my mout and E kon give mi di book make I chop.
3
E sey, “Man pikin, dis book wey I dey give yu so; make yu chop am till yu beleful.” I kon chop am and e sweet like honey.
4
Den God sey, “Man pikin! Go meet Israel pipol make yu tell dem anytin wey I sey make yu tok.
5
I nor dey send yu go where yu nor go hear wetin dem dey tok, but na Israel pipol I dey send yu go meet.
6
Even if I send yu go meet pipol wey dey tok wetin yu nor undastand, dem go still listin to yu.
7
But nobody for Israel go listin to yu, bikos dem nor go even gri listin to mi. All of dem too sturbon and dem nor dey hear word.
8
“Naw, I go make yor heart strong pass dia own and yu nor go fear dem.
9
I go make yu strong like rock and yu go dey hard like diamond: so make yu nor fear dem at-all.”
10
God still sey, “Man pikin, listin well-well kon remember evritin wey I tell yu.
11
Den go tell yor kountry-men for Babilon wetin mi wey bi God dey tell yu; weda dem listin or not.”
12
Den God Spirit karry mi go up and I kon hear one loud vois dey sey, “Praiz and glory na God own for heaven!”
13
I hear di creatures feada dey nak togeda and di wheels kon dey make loud nois like eartkweke.
14
So God pawa enter my body with force and as en spirit dey karry mi go. I kon dey vex, but God hand rest for my head with pawa.
15
Den I kon rish Tel-Abib wey dey near Chebar River, for where di prisonas dey stay and I kon stay der for seven days, but di tins wey I si and hear, fear mi well-well.
16
Afta seven days, God kon tok to mi sey:
17
“Man pikin, I dey make yu di pesin wey go wosh ova Israel pipol. Yu go tell dem di warnin wey I give yu.
18
If I tell yu sey one wiked man go die and yu nor warn am make e shange from di bad tins wey e dey do, if e die, e go still die as sina and I go whole yu, bikos na yu make am die.
19
But if yu warn wiked pesin and e still dey sin, e go die as sina, but nor bi yor fault.
20
“If betta pesin kon start to do wiked tins and I kause wahala for am, e go die if yu nor warn am. E go die bikos of en sins; I nor go remember di good tins wey e do and I go whole yu for en deat.
21
But if yu warn am make e nor sin, e go get life and yu yorsef go dey save from my vexnashon.”
22
I feel God hand for my body and E kon tell mi, “Get up make yu go di valley, so dat I go tok to yu for der.”
23
So I go di valley and for der, I si God glory, just as I si am near Chebar River. So I fall face groun
24
and God Spirit enter my body kon raiz mi up. Den God tell mi, “Make yu go lock yorsef inside yor house.
25
Man pikin, dem go tie yu with rope and yu nor go fit go out for publik.
26
I go klose yor mout and yu nor go fit tok or warn all doz bad pipol.
27
Den wen I tok to yu again kon give yu di pawa to tok, yu go tell dem wetin mi wey bi God tok. Some of dem go listin, but some nor go listin to wetin yu dey tok, bikos na bad pipol full der.”
← Chapter 2
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 4 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48