bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 13
Ezekiel 13
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 12
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 14 →
1
God tell mi:
2
“Man pikin, make yu tok against di profets for Israel. Profets wey dey tell pipol anytin wey dem like. Go tell dem sey: ‘Make una hear God word!
3
God wey get pawa sey: E nor go betta for foolish profets wey dey follow dia own spirit, even wen dem neva si anytin at-all!
4
Israel pipol, una profets dey yuzles like animals wey dey inside dirty for di town.
5
Since dem nor gri guide di place where di wall for break or ribuild am, nor-tin go fit guide Israel pipol wen God wahala go kom.
6
Dia vishon na lie and anytin wey dem tok sey go happen, nor dey happen. Dem dey sey na my message dem dey prish, but I nor send dem and dem dey espect sey wetin dem tok, go happen!
7
I tell dem sey all doz vishon wey dem si, na lie dem bi and evritin wey dem sey go happen, nor go happen. Una sey na my word, but I neva follow una tok anytin wons!’ ”
8
Den God kon tell mi: “Una words na lie and una vishons nor go happen. I really dey vex for una.
9
I go soon ponish una wey bi lie-lie profets, bikos wetin una dey tok, dey skata pipol. Una nor go dey der wen my pipol go gada make decision; una name nor go dey among Israel pipol and una nor go ever kom back to di land. Den una go know sey na mi bi God.
10
“Di profets deceive my pipol wen dem tell dem sey evritin dey okay. But evritin nor dey okay at-all! My pipol don build wall with stones wey nor strong and di profets kon paint am fine for dem.
11
So make yu go tell di profets sey dia wall go fall. I go send rain with big-big stone kon fall on-top am and betta strong breeze go blow am trowey.
12
Wen di wall don fall, pipol go ask di profets, ‘Wetin happen to di wall wey una paint?’ ”
13
Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “As I dey vex, I go send strong breeze with rain and big-big stone kon skata di wall.
14
I go break di wall wey dem paint and evritin go skata finish. E go fall kon kill evribody, den una go know sey na mi bi God.
15
Di wall plus doz wey paint am, go si how my vexnashon strong rish. Den I go tell una sey di wall and doz wey paint am, don skata
16
and dem bi doz profets wey tell Jerusalem pipol sey evritin dey okay, wen evritin nor dey okay!” God wey get pawa don tok.
17
Den God tell mi: “Naw, make yu si di lie-lie wimen wey dey among una. Tell dem
18
wetin God tok about dem sey: ‘Una wey dey put odas life for danger, ponishment dey wait una. Una tie majik for dia hand and give dem majik klot wear. Una tink sey una fit trap odas without sey una nor go sofa too?
19
Una disobey mi for my pipol front, so dat una go get small rice and bread to chop. Una kill pipol wey una nor suppose kill and pipol wey una suppose kill, una nor kill dem. So una dey lie give my pipol and dem dey bilive una.’ ”
20
Naw, dis na wetin God wey get pawa dey tok: “I know like dat rope wey dey una hand wey una dey use take kontrol pipol life. I go remove dem from una hand kon free doz wey una dey kontrol.
21
I go komot una priest kap kon let my pipol free from una hand wons and for all. Den una go know sey na mi bi God.
22
Una dey use una lie take diskorage good pipol; pipol wey I nor like to ponish. Una nor let evil pipol shange from di bad tins wey dem dey do, so dat dem go dey save.
23
So una lie-lie vishon, don end. I go save my pipol from una pawa, so dat una go know sey na mi bi God.”
← Chapter 12
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 14 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48