bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 8
Ezekiel 8
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 7
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 9 →
1
Six years afta King Jehoiashin and Israel pipol dey Babilon as prisonas, for di fift day for di sixt mont, di leaders for Judah kom meet mi for my house and at wons God Spirit kon enter my body.
2
I si one vishon and di tin wey I si bi like human being. From en waist go down, e bi like fire wey dey burn, while from di waist kom up, e dey shine like bronze wey dem polish.
3
Di tin whole my hair with en hand. Den for dis vishon, God Spirit karry mi fly go Jerusalem. E take mi go di gate where dem dey pass for di nort side for di temple and one juju wey dey make God vex, dey der.
4
For der, I si God glory, just as I don si am before wen I dey Chebar River.
5
God kon tell mi, “Man pikin, look go di nort side.” I look and for der near di altar, I si di juju wey dey make God vex.
6
God tell mi, “Man pikin, yu si wetin dem dey do so? Si di yeye tins wey Israel pipol dey do for here! Dem dey porshu mi komot from my Holy Place. Yu go even si tins wey bad pass dis ones.”
7
So, E take mi go di gate for di kourtyard kon show mi di hole wey dey di wall.
8
Den E sey, “Man pikin, break di wall.” I break am and I kon si one door.
9
E tell mi, “Go inside make yu si di bad and wiked tins wey dem don do for der.”
10
So I kon go look. Dem draw snake with oda bad animals and all dia juju for di wall.
11
Seventy Israel leaders dey der, plus Jaazanaya wey bi Shafan pikin. Each of dem whole wetin dem take dey burn incense and smoke dey kom out from am.
12
God kon ask mi, “Man pikin, yu si wetin Israel leaders dey hide do? All of dem dey woship for one room wey juju full. Dem dey sey, ‘God nor dey si us! E don leave dis land.’ ”
13
Den God tell mi, “Yu go si sey dem dey do tins wey even bad pass dis ones.”
14
So E take mi go di nort gate for di temple kon show mi wimen wey dey kry, bikos of dia juju, Tammuz.
15
E kon ask mi, “Man pikin, yu dey si dat one so? Yu go si di ones wey worse pass dis one.”
16
So E take mi go inside di kourtyard for di temple. Near di Holy Place gate wey dey near di altar and di varanda, twenty-five men dey der. Dem back di Holy Place kon dey bow face di east, dey woship di sun as e dey raiz.
17
God kon tell mi, “Man pikin, yu dey si dat one too? All dis bad tins wey Judah pipol dey do and wey don spread for di land, nor do dem, but dem still dey do am for my Holy Place and e dey make mi vex for dem more-more. Si as dem dey curse mi for outside!
18
So, dem go feel my strong vexnashon. I nor go sorry or pity for dem. Dem go shaut well-well as dem dey pray give mi, but I nor go ansa or listin to dem.”
← Chapter 7
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 9 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48