bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Ezekiel 25
Ezekiel 25
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 24
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 26 →
1
Dis na wetin God tell mi:
2
“Man pikin, turn face Ammon kon tok against en pipol.
3
Tell dem sey make dem listin to wetin mi God wey get pawa dey tok: Una dey dance wen dem kill my pipol, distroy my temple and karry my pipol go Babilon as prisonas.
4
Bikos una dey happy, I go let di tribe from east win una for war. Dem go build dia kamp for una kountry kon stay for der. Di food and milk wey suppose bi una own, dem go chop and drink dem.
5
I go turn Rabbah to where dem go dey keep kamel put and evriwhere for Ammon go bi where dem dey keep sheep, den una go know sey, na mi bi God.
6
Dis na wetin God wey get pawa dey tok: Una klap una hand kon dey jump with happiness and dey curse Israel land.
7
So, bikos una dey curse am, I go give una to anoda kountry wey go tif and skata una. I go distroy una finish, den una go know sey na mi bi God.”
8
God wey get pawa sey: “Bikos Moab pipol sey Judah bi like di oda kountries,
9
I go let dem attack di towns wey dey near Moab, plus di towns wey fine pass for Moab wey bi: Bet-Jeshimot, Baal Baal-Meon and Kiriataim.
10
I go let di east tribe for wildaness win Moab and Ammon pipol for war, den Moab nor go bi kountry again.
11
I go ponish Moab pipol and dem go know sey na mi bi God.”
12
God wey get pawa sey, “Edom pipol revensh Judah well-well and dat revensh don make Edom pipol sin.
13
Naw, I don tok sey I go ponish Edom kon kill evribody with dia animals for der. I go distroy dia land from Teman town go rish Dedan town and di pipol go die for war.
14
My pipol Israel go revensh Edom and dem go let Edom pipol feel how my vexnashon strong rish. Den Edom pipol go know wetin e mean to take revensh.” God wey get pawa don tok.
15
God wey get pawa sey, “Filistia pipol don revensh and kill Judah pipol well-well, bikos dem hate Judah.
16
But naw, I dey sey I go attack Filistia pipol kon kill all of dem. I go kill evribody wey dey Filistia and nobody go remain.
17
I go ponish and revensh dem. Dem go feel as I dey vex rish. Den dem go know sey na mi bi God.”
← Chapter 24
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 26 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48