bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 10
Job 10
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 9
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 11 →
1
“Life don taya mi; so make Yu hear as I dey tok how my heart betta rish.
2
I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’
3
E good as Yu dey opress mi? Yu dey opress wetin Yu make with yor hand. Yu dey happy for wetin wiked pipol dey do?
4
“Yu dey si tins di wey wi dey si dem? Abi Yu get di kind eye wey human being get?
5
Yor life short like awa own? Abi yor years know long life awa own.
6
Den wetin make Yu dey look for my sins and evry mistake wey I make?
7
Even doh Yu know sey I nor dey guilty, e nor get who fit save mi from yor hand.
8
“Na di same hand wey Yu take make mi, Yu won take skata mi?
9
Make Yu remember sey na san Yu take make mi; so Yu won turn mi to dat san again?
10
Na yor pawa my papa take born mi; na Yu make mi grow for my mama belle.
11
Yu make my body with bone kon kover am with flesh and skin.
12
Yu don give mi life kon show mi yor love wey nor dey die. Na bikos yu kare for mi naim make mi still dey alive.
13
But na naw I know sey for all dat time, Yu dey plan to wound and kill mi.
14
Yu dey look to si weda I go sin, so dat Yu nor go forgive mi.
15
If I sin, na big wahala Yu dey give mi, but if I do betta tin, Yu nor go gri reward mi. I don taya, na shame and trobol kover mi so.
16
If I sey make I karry body up, Yu go porshu mi like lion and na mi Yu go use take show yor pawa.
17
Yu must get pipol wey go tok against mi; yor vexnashon dey big evriday by day and na new attack Yu always dey plan for mi.
18
“God! Why Yu let my mama born mi? I for don die, before anybody si mi.
19
To die for my mama belle, for betta pass dis one wey I dey so.
20
Abi my life neva finish? Make Yu leave mi with my own! Abeg, make I enjoy di small life wey I still get.
21
I go soon go di land where Yu nor go fit si mi and I nor go kom back again.
22
I go-go di dark place where dead pipol and konfushon dey. Place where lite nor dey-dey.”
← Chapter 9
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 11 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42