bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 29
Job 29
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 28
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 30 →
1
Job still sey:
2
“If to sey my life go fit bi as e bi before wen God dey look and guide mi!
3
Dat time, God always dey with mi and E dey give mi lite wen I dey waka for darkness.
4
Dat na di time wey evritin still dey well with mi. Den God goodness still dey protet my house.
5
Den God still dey with mi and all my shidren gada round mi.
6
My melu and goats dey give mi plenty milk and my olive tree dey grow for groun wey dry and strong.
7
Wen ever di town eldas dey meet and I go der,
8
yong boys dey stand as soon as dem si mi dey kom and old pipol dey stand greet mi with respet.
9
Di leaders wey dey lead di pipol go stop to tok.
10
Even di pesin wey dey important pass, go shut up for mi.
11
“Evribody wey hear from mi, dey praiz mi. Doz wey hear mi dey tok, go-go tok good about mi.
12
Wen poor pipol kry kom meet mi, I dey help dem; I dey help pikin wey nor get papa and mama and doz wey nor get where to go.
13
Doz wey dey face wahala, dey praiz mi and I dey protet and guide wimen wey dia husband don die.
14
I dey always do betta tin. Evritin wey I do dey always dey good.
15
Na mi bi blind pipol eye and doz wey nor fit waka, na mi bi dia leg.
16
I bi like papa to poor pipol and I dey setol matter even for doz wey I nor know.
17
I dey distroy wiked pipol pawa kon release di pesin wey dem katch.
18
“Den I sey, I go get long life kon die for my house without trobol.
19
I go bi like tree wey en rut get wota; wey dew dey wet en branches.
20
Evribody go dey praiz mi and my pawa nor go fail.
21
“Wen I dey advise pipol, dem dey kwayet listin to wetin I dey tok
22
and dem nor dey get anytin to tok wen I don tok finish. My word dey enter dia mind well.
23
Evribody dey welkom mi, just as farmer dey welkom rain wey won fall.
24
I dey smile give dem wey nor bilive diasef again and my betta face dey give dem hope.
25
I dey lead dem as king dey lead many pipol kon konfort dem wen dem dey face trobol.
← Chapter 28
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 30 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42