bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 40
Job 40
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 39
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 41 →
1
Den God tell Job:
2
“Yu dey argue with God Almighty; yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?”
3
Den Job ansa God:
4
“True-true, I dey tok like fool since, wetin I go fit ansa? I nor go try tok anytin again.
5
I don tok pass wetin I suppose tok. I nor get anytin to tok again?”
6
Den from inside di storm, God kon ansa Job:
7
Make yu stand strait kon ansa my kweshons.
8
Yu dey try to sey I dey wiked, bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite?
9
Yu strong rish mi? Abi yor vois loud rish my own?
10
If na so, stand up make yu ansa mi; dress like king make yu hail yorsef.
11
Look pipol wey tink sey dem dey important, den go honbol dem, bikos yu dey vex.
12
Yes! Look dem, make yu bring dem kom down kon skata where wiked pipol stand put.
13
Beri all of dem for groun kon tie dem for where dead body dey.
14
Den na mi go first praiz yu kon gri sey yu don win di fight by yorsef.
15
Si Behemot; I make am di way I make yu, e dey chop grass like melu,
16
but si as en strent bi like lion own and e pawa dey en body.
17
En tail stand like tall tree and di pawa wey dey e leg, strong well-well.
18
En bones strong like bronze and en leg bi like iron bar.
19
E dey among di tins wey God kreate wey dey sopraiz pipol! Na only God wey kreate am go fit distroy am.
20
Grass wey dem go chop, dey grow for di hill wey bush animals dey for play.
21
E dey sleep for under tree wey valley wota dey pass and e go hide among di reeds for di bush.
22
Inside bush dey gi-am betta place to rest. Di tall tree dey gi-am shade.
23
E nor dey fear wota wey dey rush pass like river; en body go kold wen Jordan River flow pass en face.
24
Who fit blind en eyes kom katch am? Na who fit use trap katch am thru en nose and mout?
← Chapter 39
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 41 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42