bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 19
Job 19
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 18
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 20 →
1
Job ansa:
2
“Bildad, na wen yu go stop to ponish and worry mi with yor words?
3
Yu don already curse mi rish ten times. Yu suppose to dey shame as yu dey trit mi like dis.
4
Even if I do bad tin, how dat one take koncern yu?
5
If yu feel sey yu betta pass mi kon dey use my trobol against mi,
6
den make yu know sey na God handwork bi dis, bikos na-im set trap wey katch mi so.
7
“If I kry out bikos of dis trobol sef, nobody go ansa mi. I dey kry for help, but nobody dey hear am.
8
God don block my way and I nor fit pass; E don hide my way for darkness.
9
E don take all my glory kon distroy my respet.
10
E skata mi for evry side, until I nor get hope again.
11
God dey vex for mi, so E kount mi join en enemies.
12
En sojas kom attack mi; dem skata my life kon build dia kamp round my house.
13
“God don make my family far from mi; I don turn strenja to pipol wey know mi.
14
My family don go leave mi. My friends don forget mi.
15
Even di strenjas for my house don forget mi and my wimen savant dey do like sey na mi bi strenja.
16
Wen I koll my savant, e nor gri ansa, even wen I beg am with my own mout.
17
My wife nor fit stay where I dey breath and my own broda nor gri kom near mi.
18
Shidren sef dey laf wen dem si mi. Wen I won tok, dem go turn waka leave mi.
19
My klose friends dey look mi with shame and di ones wey I love, don turn against mi.
20
My bones just whole my skin and I just manage dey run with my life.
21
Una wey bi my friends! Make una sorry for mi naw, bikos God don nak mi fall with en hand.
22
Why yu dey porshu mi, just as God dey porshu mi? Abi yu neva trobol mi rish?
23
“I for like sey somebody go remember all wetin I dey tok, make e for rite dem for book!
24
Or make e karve and rite di words for stone, so dat dem go dey forever.
25
But I know sey God dey for heaven and E go kom save mi for di end.
26
Even wen sickness don chop my skin, as I still dey dis body, I go si God.
27
I go si am with my eye and E nor go bi anoda pesin at-all.
28
So wetin make yu dey akuiz mi dey sey, ‘Na yu kause di wahala wey yu dey face?’
29
But fear di swod naw; dat swod wey dey bring God ponishment. So make yu know sey e get pesin wey go judge my kase.”
← Chapter 18
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 20 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42