bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 8
Job 8
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 7
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 9 →
1
Bildad wey kom from Shuah kon sey:
2
“Job, wen yu go stop to dey tok like dis, wen e bi sey di word wey dey yor mout bi like strong wind?
3
Abi God nor dey like justice? Abi God nor dey do wetin dey rite?
4
Yor shidren go don sin against God, naim make am pay dem for dia sin.
5
But if yu look up to God kon beg di Oga wey dey mighty;
6
if yu klean yorsef kon koll am yor Savior, E go help yu kon give yu back evritin.
7
Yor biginnin fit dey small for eye naw, but yor ending go betta well-well.
8
Make yu ask generashons wey don pass; tink and follow di trut wey dem sabi;
9
bikos dis life wey wi dey so, short well-well. Wi nor know anytin at-all and awa days for dis eart bi like shadow wey go kwik vanish.
10
But make yu let doz wey get sense before dem die, tish yu; make yu listin to wetin dem dey tok:
11
Papyrus plants fit grow for where river nor dey? Abi reed fit grow without wota?
12
If wota dry, na dem go first die wen e neva rish to kut or use dem.
13
Pipol wey nor dey fear God bi like di reed; dia hope don go as dem just forget God.
14
Dem bilive bad-bad tins and dia sekurity bi like spider house.
15
If dem rest for spider house, e go fit hold dem? If dem hold di spider rope, e go fit make dem stand?
16
Wiked pipol plenty like betta grass for sun wey dem dey wota, wey skata around di gardin.
17
Dem wrap dia rut for plenty stone kon dey look for where dem go hide put for di rock.
18
But if dem rut dem komot for dia place, dat place go rijet dem kon sey, ‘I neva si una before!’
19
Yes, dat na all di joy wey wiked pipol get and from inside di eart, odas go kom take dia place.
20
But God nor go ever help wiked pipol kon let pesin wey dey fear am, sofa.
21
E go pak laf full yor mout and yor lip go dey happy.
22
But E go disgrace pipol wey hate yu and wiked pipol house go vanish.”
← Chapter 7
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 9 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42