bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 28
Job 28
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 27
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 29 →
1
Job sey, “Where dem for dey dig silva, na der precious stones dey and e still get where dem for dey rifine gold too.
2
Na from groun dem for dey dig iron and melt koppa.
3
Man don end darkness, bikos dem shine lite dey search under di eart and dey dig rock wey dey for darkness.
4
Where dem for dig di precious stones dey far from where pipol dey stay and nobody dey travel pass der again. Dem dey stagga fall and pipol nor dey der.
5
Even doh food dey kom from di eart, evriwhere under di eart, don skata like wetin fire burn.
6
Na betta stone dey di eart and gold dey en dust.
7
No bird know di road wey lead to where gold dey and know vulture don fly pass or si am before.
8
No lion or oda wiked animals fit travel pass dat road wons.
9
Pipol dig di rock and mountins wey hard pass bikos dem dey find gold.
10
As dem dey dig hold for di rock, dem kom si precious stones.
11
Dem dig rish wota kon bring wetin dem hide, kom out for lite.
12
“But where wi go fit si wisdom? Where wi go fit learn how to undastand?
13
Yu nor fit si wisdom with human being; bikos e nor dey among pipol wey dey alive.
14
Even bottom river sey, ‘E nor dey with mi’ and under sea sey, ‘E nor dey with mi too.’
15
Dem nor go fit buy wisdom with gold or silva.
16
Di gold and jewel wey fine pass nor get value rish wisdom.
17
Wisdom dey more important pass gold; e even dear pass where gold full or where fine glass dey.
18
Wisdom get betta value pass diamond or fine glass.
19
Topaz stone wey fine pass and di gold wey klean pass, dem nor fit kompare dem with wisdom.
20
“But where wisdom from kom sef? Where wi go for fit learn how to undastand?
21
Nor-tin wey dey live for dis life fit si wisdom, even di birds wey dey fly nor fit si am.
22
Deat and distroshon agri sey, na hear dem just dey hear.
23
Na only God know di way and place where dem fit si wisdom,
24
bikos E dey si di end for di eart and E dey si evritin wey dey under di sky.
25
Na God give breeze pawa kon measure where di sea go rish.
26
Na God dey choose where di rain go fall rish and where tonda go travel pass.
27
Na der E si wisdom kon test as e important rish, den E si sey e dey good.
28
God tell human being, ‘Before una go get sense, una must woship mi. Una go turn live bad tins, before una go fit get undastandin.’ ”
← Chapter 27
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 29 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42