bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 24
Job 24
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 23
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 25 →
1
“Why God nor set di time wen E go take judge pipol; di day wey E go judge di pipol wey dey woship am?
2
Stone wey dem take mark land, pipol dey move am komot from where dem put am, so dat dem go get many land; dem still dey tif animals join dia own.
3
Shidren wey nor get papa and mama again, dem dey take dia donkey and bikos of di money wey wimen wey nor get husband dey hold, pipol dey seize dia animals.
4
Dem nor let poor pipol get wetin dem suppose get and doz wey nor get at-all, dey run go hide.
5
Just like wiked donkey for desert, na so poor pipol dey find food waka. Dem even dey find food rish desert so dat dia shidren go chop.
6
Dem just dey work for land wey nor bi dia own and dem dey chop from wiked pipol land.
7
For nite, dem dey sleep without kover klot; nor-tin dey to keep dem from kold.
8
Rain wey dey fall on-top di mountin dey beat dem and dem dey go hide under rock, bikos dem nor get house.
9
Wiked pipol dey use small pikin wey nor get papa take do slave kon seize poor pipol shidren, bikos of di money wey dem dey hold.
10
But poor pipol dey naked go out; na with honga dem take dey work.
11
Dem go press oil kom out from olive fruit and wine from grape fruit, but demsef nor go even si wota drink.
12
For inside town, doz wey wound and di ones wey dey die, dey kry, but God nor dey ansa dem.
13
E get pipol wey rijet di lite; dem nor undastand di lite or follow where e dey lead dem go.
14
For day break, wiked pipol go get up go kill poor pipol and for nite, dem go-go tif dia propaty.
15
Di ones wey don marry wey dey sleep with oda pipol, go kover dia face make nobody si dem.
16
For nite, tif go break enter pipol house, but for day time, di tif go-go hide from lite.
17
Dem dey fear morning lite, but dem nor get anytin to fear for nite.
18
But na wota go karry wiked pipol go; God go curse dia land and nobody go work for dia farm again.
19
As snow dey dry for heat and melt for sun, na so sinnas go vanish from dis land.
20
Even dia mama nor go remember dem again. Na worm go chop dem and dem go bi like tree wey dem kut trowey.
21
Dem dey ponish wimen wey dia husband don die and doz wey nor get pikin.
22
But God go distroy wiked pipol with en pawa; wen God take akshon, wiked pipol nor get hope again.
23
God fit let dem stay for peace, but en eye nor go komot for dia body at-all.
24
Wiked pipol fit dey great naw, but e nor go tey before dem go die go like grass and korn wey dem kut trowey.
25
If nor bi so e bi, who go fit sey I dey lie or sey wetin I tok, nor bi true?”
← Chapter 23
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 25 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42