bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 39
Job 39
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 38
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 40 →
1
Yu know how dem take born di goats wey dey stay mountin? Yu don si wen bush animals dey born before?
2
Yu know how long dem dey karry dia shidren for belle? Yu know di time wey dem take dey born?
3
Yu know how dem take bend down for groun born dia pikin?
4
For inside forest dia pikin dey grow dey strong and wen dem waka go dia own, dem nor dey kom back again.
5
Donkey wey dey forest, na who give dem freedom? Who release and let dem dey waka up-and-down?
6
Na mi give dem di desert make dem stay. I sey make dem stay di empty land.
7
Dem nor dey stay near di town at-all, dem dey far and nobody fit go katch dem kom work.
8
Na for mountin dem for dey si food chop, na der dem for dey si green leaf chop.
9
How bush melu won take work for yu? E go gri stay one nite for yor yard?
10
Yu fit use rope tie bush melu make e for follow yu klear di field?
11
Yu sure sey e go gri use en pawa take do yor heavy work?
12
Yu dey espect am to bring wetin e harvest kon gada am for di place where korn dey?
13
Si as ostrich wey get long leg dey run, but e nor fit fly like stork.
14
E dey leave en egg for groun make heat for warm dem.
15
E nor dey kare sey pesin leg fit mash di egg or wiked animal fit kom break dem.
16
E dey bihave like sey nor bi en get di egg and e nor koncern am if di egg break or skata.
17
Na mi make am nor get sense like dat! Na mi nor gi-am wisdom.
18
But wen e don start to run, e dey laf horse and di pesin wey dey ride am.
19
So Job, na yu make horse strong like dat or na yu give dem hair like klot for dia neck?
20
Na yu dey make dem jump like lokust kon make pipol fear wen dem breath?
21
Dem dey skata groun as dem dey run for valley; dem dey rush enter war with all dia pawa.
22
Dem nor know wetin fear mean and know swod fit make dem turn back.
23
Di swod wey who dey ride dem karry, dey make nois and shine for di sun.
24
Horse dey run go, bikos dem just dey happy anyhow; even wen dem don blow di trumpet, dem nor go gri stop.
25
As dem hear di trumpet dem go vex; dem fit smell war even before dem near der and dem dey hear dia oga kommand.
26
Hawk dey kom ask yu make yu tish am wisdom, so dat e go know how to fly wen e spread en feada face sout?
27
Abi eagle go wait for yor kommand before e go build en nest for mountin?
28
E build en house for di rock wey high pass kon use rock take do pillow for nite.
29
From dat place, e dey find sometin wey e go chop, even if e dey near or far.
30
Eagle dey gada round dead body, while small eagle dey drink dia blood.”
← Chapter 38
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 40 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
Recommended Reading
Commentary
Job Commentaries
→
Devotional
Job Devotional Guide
→
Get This Bible
Nigerian Pidgin Bible Study Bible
→