bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 41
Job 41
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 40
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 42 →
1
“Yu fit use fish hook take katch Leviatan or use rope take tie en tongue?
2
Yu fit put rope pass en nose or hook en jaw?
3
E go beg yu make yu let am go? Or make e beg yu make yu sorry for am?
4
E go gri make agriment with yu kon promise sey e go serve yu forever?
5
Yu go fit tie am like bird wey dem dey train for house; or like sometin wey go sweet yor wimen savant to play with?
6
Pipol wey dey katch fish go gri follow am enter agriment? Pipol wey dey sell pesin go gri sell am?
7
Yu go fit tosh en skin with spear wey dem take dey katch fish or katch en head with hook?
8
Make yu try go tosh am, den yu nor go ever try am again; bikos yu nor go ever forget di fight!
9
Anybody wey si Leviatan go fear fall for groun.
10
Wen dem don make am vex, e go shaut and nobody go try go stand for en front.
11
Who don give mi anytin kon sey make I pay back? Evritin wey dey under heaven na my own?
12
Make I tell yu about Leviatan leg kon tell yu how e dey big and strong well-well.
13
Nobody fit tear en klot wey dey outside or shuk di armour wey e wear.
14
Who fit open en mout or bring en tit wey dey make pesin fear, kom out?
15
Na many shield dem take make en back kon tie dem togeda and dem strong like stone.
16
Dem join dem strong well-well and space nor dey wey breeze fit pass enter en body.
17
En body strong well-well and nor-tin fit tear am En body join togeda and nor-tin fit separate dem.
18
Wen e sneeze, lite go flash kom out and na so en eye dey shine like sun for aftanoon.
19
Fire and tonda lite dey kom out from en mout.
20
Like grass wey dey burn under pot, na so too smoke dey kom out from en nose.
21
Fire dey kom out from en mout and even wen e breath, e dey bring fire.
22
En neck get strong pawa wey fit make evribody wey near am, fear.
23
E nor get any weak part for en skin; e dey strong well-well and e bi like iron wey dem nor fit bend.
24
En heart bi like stone wey nor dey fear anytin; e dey strong well-well like grindin stone.
25
Wen e stand, even pipol wey strong well-well, dey fear and di fear dey make dem shake anyhow.
26
No swod fit wound am; no spear or arrow fit enter en body.
27
Iron just bi like straw for en eye and bronze dey soft like wood wey don rotin.
28
E nor get di arrow wey won make am run, even wen dem stone am with rock, e bi like straw for en body.
29
Spear bi like straw to am and e dey laf wen men dey trow arrow kom meet am.
30
Di skale wey dey en belle bi like pot wey don break; as e dey waka, e dey leave mark for di mud like sey e won separate di groun.
31
E dey shake di sea like wota wey dey boil kon make am dey dance like oil for pot.
32
E dey leave shine-shine part for en back kon make di sea get white foam.
33
E nor get anytin for eart wey yu fit take kompare am and I kreate am without fear.
34
Even di animal wey dey karry body up, e dey look dem like nor-tin; bikos naim bi king among all animals.”
← Chapter 40
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 42 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42