bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 31
Job 31
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 30
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 32 →
1
“I don swear with my eye sey I nor go ever look wimen kon sey I won sleep with dem.
2
Wetin God for heaven choose for us? Wetin wi go gain from di Almighty wey dey heaven?
3
Shebi trobol na for doz wey dey do bad tins and wahala for wiked pipol?
4
God know evritin wey I dey do; E dey si evry step wey I dey take.
5
I neva do wiked tin before and I neva ever lie to anybody.
6
Make God just test mi weda I dey klean and E go si sey I nor do any bad tin.
7
If I don komot from di rite way; if my heart don follow wetin my eye si or if sin full my hand,
8
den make anoda pesin chop wetin I plant. Make dem rut and distroy evritin wey I plant.
9
If I dey like and won sleep with woman for my heart kon dey wait and hide outside en door,
10
den make my wife kook for anoda man chop and make e sleep for anoda man bed.
11
Bikos dat go bi big shame and na deat dem take dey ponish dat kind wikedness.
12
Make e bi like hell-fire wey dey distroy tins; fire wey go burn evritin wey I get.
13
If any of my savant komplain give mi, I dey listin and I dey trit dem well.
14
If I nor dey do dem well, how I won take face God? Wetin I won tok if God kom judge mi?
15
Na di same God wey kreate mi, kreate my savants too.
16
I dey always help poor pipol; I neva let wimen wey nor get husband live for pain
17
or allow shidren wey nor get papa and mama dey hongry, while I dey chop.
18
Na since wen I small I don dey kare for doz wey nor get papa and mama and till I die, I go always dey kare for wimen wey dia husband don die.
19
If I si pesin wey nor get at-all; wey won die, bikos e nor get wetin to wear,
20
I go gi-am klot wey dem use my own animal wool take make. Den e go tank mi with en hold heart.
21
If I don ever do bad to who nor get papa and mama, bikos I know sey I go win di matter wen wi go kourt,
22
den make my hand break. Make e break komot from my shoulder.
23
But bikos I dey fear God ponishment, I nor fit do dat kind tin.
24
I neva ever bilive money. I nor ever si am as wetin go protet mi
25
or kom dey karry body, bikos of di money wey I get.
26
I neva ever woship sun, bikos e dey give lite or di moon, bikos e fine.
27
I neva for one day like dem rish wen I go kon dey kiss my hand dey woship dem.
28
Na deat dem take dey reward dat kind sin; bikos e go mean sey I nor honor God name.
29
I neva happy wons, bikos my enemies dey sofa; or dey for peace, bikos dem dey face trobol.
30
I neva ever pray make dem die, bikos if I do like dat, God nor go forgive mi.
31
My savants neva ever sey, ‘Awa oga let hunga kill some pipol.’
32
Doz wey dey travel, I dey koll dem enter my house and I nor dey let dem travel or sleep for road wen nite rish.
33
Oda pipol dey try to hide dia sin, but I neva ever hide my own.
34
I nor dey kwayet or stay for inside house, bikos I dey fear sey pipol go curse or tok against mi.
35
“Nobody won listin to wetin I dey tok? I swear sey evry word wey I dey tok na true. Make God kom ansa mi. Make dem rite wetin my enemies tok about mi, so dat I go si dem.
36
I go karry dem without shame for my shoulder kon wear dem like king crown.
37
I go dey proud to tell God evritin wey I don do. I go waka go meet am like prince.
38
“If I tif di land wey I for dey farm or take am from di original owner,
39
or chop di food wey grow for der, so dat di owner nor go si chop,
40
den instead of fruit or korn to grow, make bush and grass grow full dat land!” Den Job kon stop to dey tok.
← Chapter 30
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 32 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42