bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 5
Job 5
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 4
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 6 →
1
“Job, make yu koll naw, if anybody go ansa yu? Na who dey holy wey yu won go meet?
2
Na vexnashon dey kill who nor get sense and na jealousy dey kill fool.
3
I don si sey fool fit dey progress, but na wons wahala go kom distroy evritin wey e get.
4
Dia shidren nor dey save; no lawyer dey to defend dem for kourt.
5
Doz wey dey hongry go chop wetin di fool dem plant; grass go grow kover wetin dem plant. Pipol wey get long-trot, go tif dia propaty.
6
Evil nor dey grow from dust or trobol from groun.
7
But just as lite dey shine go up, na so too dem born pesin enter trobol.
8
“But if na mi, I go look for God kon komplain gi-am.
9
Wi nor go fit know di great tins wey E dey do and en wonders nor get end.
10
E dey give rain to di eart and wota for di san.
11
Na God dey karry doz wey dey honbol go up and give joy to doz wey dey mourn.
12
E skata and make sure sey wayo pipol nor fit do wetin dem plan!
13
E dey katch pipol wey feel sey na dem get sense pass kon end dia wayo work.
14
Dem dey waka for darkness for day time. For aftanoon, dem dey waka dey find road like sey dem dey darkness.
15
But na God dey save poor pipol from deat. E dey save doz wey nor get, from doz wey get pawa.
16
E dey give hope to di poor kon silent wiked pipol.
17
Na blessing dey follow di man wey God korrect! So make yu nor komplain wen God dey ponish yu for yor sins.
18
God go kover where E for wound yu; na en hand wound yu and na dat same hand E go take heal yu.
19
E go save yu from trobol six times and wen e rish di sevent one, evil pipol nor go fit tosh yu.
20
Wen honga kom, E go keep yu alive; wen war kom, E go protet yu, so dat yu nor go die.
21
God go diliver yu from trobol; E go save yu wen distroshon kom.
22
Yu go laf trobol and honga; yu nor go fear wiked animals again.
23
Di land wey yu klear go dey free from stones and wild animals nor go kom near am.
24
Peace go dey yor house and wen yu look yor propaty, evritin go komplete.
25
Yu go get many shidren! Dem go plenty like grass for dis eart.
26
Just as rice dey wait until den won harvest am, na so too yu go old before yu die.
27
Job, wi don study dis tin wey dey happen and wi know sey na true. So, hear dis words make yu use am for yor own good.”
← Chapter 4
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 6 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42