bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Job 18
Job 18
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 17
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 19 →
1
Bildad wey kom from shuh kon sey:
2
“Job, wen yu go stop to dey tok? If yu stop, wi go tok to yu.
3
Wetin make yu dey feel sey wi nor get sense like animals?
4
Yu just dey kill yorsef with vexnashon. Make di eart skata, bikos yu dey vex? Abi make mountins shake komot where e dey?
5
Wiked pipol lite go soon off; dia fire nor go ever burn again.
6
Di lite for dia house go dark; di lantan wey dey dia room go off.
7
Dem dey waka well before, but naw, dem go dey stagga; na dia own advise go distroy dem.
8
Wiked pipol go waka enter net and e go katch dia leg.
9
Trap go katch dia leg kon hold dem for der.
10
Dem hide rope for dem for groun kon set trap for where dem go waka pass.
11
Fear dey wait dem for evriwhere and e go follow dem as dem dey waka.
12
Sofa dey hongry dem; wahala dey wait for dem to fall.
13
Sickness don chop dia body finish and na dis make dia hands and legs dey rotin.
14
Dem don skata di house where dem for dey save and naw, na di king wey dey make pesin fear, go judge dem.
15
Fire go burn wiked pipol house. Yes fire with sulfur don skata dia house rish groun?
16
Dia rut don dry finish and dia branches go skata.
17
Pipol nor go remember dem for dia house or for outside again, bikos dia name don fade komot from di land.
18
Dem go porshu dem from where pipol stay kon still porshu dem from lite enter darkness.
19
Dem nor get shidren, grand-shidren or pesin wey go live afta dem don die.
20
From east go west, evribody wey hear wetin happen to dem, go fear kon sey,
21
‘True-true, na so wiked pipol house dey bi and pipol wey nor know God, na dem dey stay dis kind place.’ ”
← Chapter 17
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 19 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42