bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 12
Genesis 12
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 11
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 13 →
1
Naw, God kon tell Abram sey, “Komot from yor kountry; leave yor relashon and yor papa house kon go di land wey I go show yu.
2
“Den I go turn yu to one strong kountry kon bless yu. Yor name go dey great and yu go get betta blessing.
3
I go bless doz wey bless yu, but doz wey curse yu, I go curse dem too. All di family for dis eart, go get blessing, bikos of yor name.”
4
So Abram kon go, just as God tell am sey make e do and Lot follow am go too. (Naw, Abram na seventy-five years wen e komot from Haran.)
5
Abram take en wife Sarai, en broda pikin Lot and evritin wey e get, plus di pipol wey dey with dem for Haran and all of dem kon go Kanaan land.
6
Abram travel pass Moreh oak tree for Shekem. (For dat time, Kanaan pipol dey stay for di land.)
7
God appear to Abram kon sey, “I go give dis land to yor shidren-shidren.” So Abram build one altar to God wey appear to am for der.
8
Den e komot from der go di hill kountry for Bethel for east kon stay der. E build anoda altar for der for God kon woship am.
9
Abram kon dey travel small-small until e rish Negev.
10
But honga kon dey di land, so Abram go Egypt go stay der small, bikos di honga strong well-well.
11
As e near Egypt, e kon tell en wife Sarai sey, “Si o-o, I know sey yu bi fine woman
12
and wen Egypt men go si yu, dem go sey, ‘Dis na en wife.’ Den dem go kill mi bikos of yu.
13
So make yu tell dem sey, yu bi my sista, so dat dem nor go kill mi.”
14
Wen Abram enter Egypt, Egypt pipol si as di woman fine well-well.
15
Wen Fero offisa si di woman, dem kon tell Fero about am
16
and e trit Abram well, bikos of di woman. Abram kon kollect sheep and kattle, both man donkey and kamel.
17
But God kon send one bad diziz enter Fero house, bikos of Sarai, Abram wife.
18
So Fero koll Abram kon sey, “Wetin bi dis wey yu don do so? Why yu nor tell mi sey dis woman na yor wife?
19
Wetin make yu sey, ‘Di woman na my sista?’ Naw, I don take am as my wife! Make yu take di woman and make una komot for here!”
20
So Fero kon orda en offisa make dem porshu Abram, en wife and evritin wey bi dia own, komot from di town.
← Chapter 11
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 13 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50