bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 9
Genesis 9
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 8
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 10 →
1
Den God bless Noah and en shidren kon tell dem, “Make una born full di eart.
2
Evritin wey I kreate for dis eart go dey fear una, both animals and birds for sky. Evritin wey dey creep for groun and di fish for inside sea, go dey under una pawa.
3
Una fit chop anytin wey still dey waka. As I give una di green plant, na so too I don give una evritin.
4
But make una nor chop meat wen en blood still dey inside am.
5
If anybody kill pesin, I go ponish am. I go kill any animal wey kill human being.
6
“Na as God bi, dem make man, so anybody wey kill pesin, na so too anoda pesin go kill-am.
7
But yu go get many shidren and dem go many kon full di whole eart.”
8
God kon tell Noah and en sons sey,
9
“Si! I dey make my kovenant with yu and yor shidren-shidren
10
and with evritin wey dey alive: all di birds and animals, evritin wey follow yu kom out from di boat.
11
Na with dis word I take enter kovenant with yu; I promise sey I nor go ever distroy di eart with wota again.”
12
And God sey, “Dis na di sign for di kovenant wey I dey make with yu and evritin wey get life and dis kovenant na from one generashon go rish anoda:
13
I go use rainbow as sign for di sky and e go bi sign for di kovenant wey I make with di eart.
14
Wen ever I bring kloud make e kover di eart and di rainbow sign appear for di sky,
15
den I go remember di kovenant wey I make with una and evritin wey get life akordin to how dem bi. Wota nor go ever kom distroy di eart and evritin wey get life again.
16
Wen di rainbow dey for di kloud, I go si am kon remember di everlastin kovenant between mi and evritin wey get life for dis eart.”
17
So God tell Noah, “Dis na sign for di kovenant wey I make between mi and evritin wey get life for dis eart.”
18
Noah sons wey kom out from di boat na Shem, Ham and Jafet. (Na Ham bi Kanaan pipol papa.)
19
Dis na Noah sons and from dem, pipol kon full di whole eart.
20
Noah wey bi farmer na-im bi di first man to plant vineyard.
21
Wen e drink some for di wine, di drink kon katch am and e naked for inside di tent.
22
Ham wey bi Kanaan papa kon si sey en papa dey naked and e kon tell en two brodas wey dey outside.
23
Shem and Jafet take di klot kon put am for dia shoulder. Den dem kon take back waka enter kon kover dia papa nakednes.
24
Wen Noah wake-up from en sleep, e kon si wetin e sons do to am.
25
So e sey, “I curse Kanaan! Na en go bi slave to en brodas.”
26
E still sey, “Make wi praiz God wey bi Shem God and Kanaan go bi en savant.
27
Anytin wey Jafet put en hand, God go make am betta! Make e stay Shem tent and Kanaan go bi en savant!”
28
Afta di rain, Noah stay for three hundred and fifty years.
29
Di total life wey Noah stay na nine hundred and fifty years, den e kon die.
← Chapter 8
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 10 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50