bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 7
Genesis 7
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 6
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 8 →
1
So Oga God tell Noah, “Make una enter di boat, yu and yor family, bikos I si sey yu nor get fault among evribody for dis yor generashon.
2
Yu must karry seven man and seven woman for evry klean animal follow body, but for evry animal wey nor dey klean, yu go take only one man and one woman.
3
Den yu go still take seven man and seven woman from evry kind bird wey dey fly for sky, so dat dem go born many shidren leta.
4
Bikos seven days from naw, I go send rain kom di eart for forty days and forty nite kon kill evritin wey get life wey I kreate.”
5
So Noah do as God kommand am.
6
Noah don rish six hundred years wen wota kover di eart.
7
Noah enter di boat with en sons, en wife and en shidren wife dem wen di rain won fall.
8
Two-two from evry klean animal; animals wey nor klean; birds and evritin wey dey creep for groun,
9
both man and woman, all enter di boat kom meet Noah, just as God kommand am.
10
And afta seven days, di rain kon start to fall.
11
Wen Noah don old rish six hundred and two monts, for di seventint day for di mont, all di wota for sky bigin rush anyhow and di heaven kon open,
12
den rain from heaven kon start to fall for di eart for forty days and forty nites.
13
For dat very day, Noah enter di boat with en sons Shem, Ham and Jafet, plus en wife and en shidren wife.
14
Dem enter with evry kind tin wey get life; difren animal; evritin wey dey creep for groun akordin to how dem bi and evry bird akordin to how dem bi, plus evritin wey get feada.
15
Two-two from evritin wey get life kom meet Noah inside di boat.
16
Doz wey enter na man and woman, just as God kommand am. Den Oga God klose di boat door.
17
Di wota fall for di eart for forty days. As di wota dey many, di boat dey go up.
18
Di wota kover di eart and di boat kon dey float on-top di wota.
19
Di wota kon kover di eart sotey e even kover di mountins wey high pass for di eart.
20
Di wota kon high rish twenty fit afta e don kover di mountins wey high pass.
21
And evritin wey get life for di eart kon die: di bird for sky, animals, both di ones for house and wiked ones; evritin wey dey di eart and all human being.
22
Evritin for land wey dey breath thru dia nose kon die.
23
So Oga God distroy evritin wey get life for di eart: pipol, animals, di ones wey dey creep for groun and birds for di sky. All of dem die komot di eart. Only Noah and doz wey dey with am for di boat, naim save.
24
Di wota kover di eart for one hundred and fifty days.
← Chapter 6
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 8 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50