bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 23
Genesis 23
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 22
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 24 →
1
Sarah stay for one hundred and twenty-seven years.
2
E die for Kiriat-Arba (wey bi Hebron naw) for Kanaan land. Abraham mourn and kry for Sarah.
3
Den Abraham get up from where e for dey mourn en wife wey die kon tell Het pikin dem sey,
4
“Na strenja I bi for una land and I go soon komot here, so make una give mi land where I go beri my wife put.”
5
Het pikin dem ansa Abraham,
6
“Oga, make yu listin to us. Yu bi prince wey get betta pawa among us! Yu fit beri yor wife for di best land wey wi get for here. All of us go happy to give yu land make yu beri yor wife put.”
7
Abraham stand up kon bow for Het shidren.
8
Den e tell dem, “If una gri sey make I beri my wife for here, den make una hear wetin I won tok. Make una ask Efron, Zohar son
9
if e go sell Makpelah grave wey bi en own give mi; e dey di end for en field. Make e sell am give mi for evribody front for di normal prize, so dat I go beri my wife for der and e go kon bi awa burial groun.”
10
(Naw Efron sidan with Hit shidren.) Efron wey bi Hit pesin kon ansa Abraham for front of Het shidren and evribody wey dey kom thru di town gate sey,
11
“Okay my oga! I go sell both di field and di grave give yu. For my pipol front, I sell am give yu. Make yu go beri yor wife for der.”
12
Abraham bow again for di pipol
13
kon tell Efron for dia front sey, “Abeg, make una listin to mi. I go pay yu di prize for di field. Take am from mi, so dat I go fit go beri my wife for der.”
14
Efron ansa Abraham,
15
“My oga, di land na 400 silva, but dat one nor mean anytin at-all. So go beri yor wife for der.”
16
Abraham agri with Efron prize, e give di money to am kon dey tok make evribody for hear am, “Dis na 400 silva, just as dem dey measure am dat time.”
17
So Abraham kon buy Efron field for Makpelah, wey dey near Mamre, plus di field, di grave and all di land wey dey near am
18
and all dem kon bi en propaty. So Het shidren and evribody wey dey enter di gate for Efron town kon bi en witness.
19
Afta evritin, Abraham beri Sarah en wife for di grave wey dey Makpelah field near Mamre (wey bi Hebron naw) for Kanaan land.
20
Abraham buy di field and di grave from Het shidren as where dem go dey beri pipol put.
← Chapter 22
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 24 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50