bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 49
Genesis 49
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 48
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 50 →
1
Den Jakob koll all en sons kon sey, “Make all of una kom, so dat I go tell una wetin go happen for future.
2
“Make una listin to mi, una wey bi Jakob shidren; make una listin to Israel wey bi una papa.
3
Reuben, na yu I first-born, my strent and di first fruit wey I plok. Na yu bi di nomba one, both for rank and pawa.
4
But yu dey skata tins like wota, so yu nor go prosper, bikos yu sleep with yor papa wife for my bed!
5
Simeon and Levi na brodas, dem like war and trobol well-well!
6
Make I neva ever join dia meetin or go where dem for gada dey make plan. Bikos as dem dey vex, dem kill many pipol kon break animals leg just as dem like.
7
I curse dia wiked mind, bikos e too strong and dia annoyance, bikos e dey bad well-well. I go divide dem inside Jakob family kon skata dem among Israel pipol!
8
Yu Judah, yor brodas go praiz yu. Yor hand go strong pass yor enemy own. Yor papa sons go bow down for yu.
9
Judah my pikin, yu bi yong lion wey just chop wetin e kill finish. Yu dey kill like lion kon kwayet dey look; yu bi like woman lion, na who go fit fight am?
10
Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.
11
E tie en donkey put for di vine, di vine wey e choose. Na wine e take dey wosh en klot and na grape e take dey wosh en garment.
12
En eyes dark pass wine and en tit white pass milk.
13
Zebulun go dey stay near di sea and e go dey kontrol many sheep for di sea, en land go long go rish Sidon.
14
Issakar na very strong donkey wey dey rest on-top two strong bags.
15
Wen e si how di kountry side bi and how di land good, e go fit bear di load wey e karry kon bi savant to odas.
16
Dan go rule pipol like any oda tribe for Israel.
17
Dan go bi like snake wey dey di road korna; like betta wiked snake wey dey bite horse leg, so dat who dey ride am go fall.
18
My Oga God, I trust Yu sey, Yu go save mi!
19
Pipol wey dey tif, go attack Gad, but e go attack dem wen dem don go back.
20
Na rish-rish food Asher go dey chop and e go dey provide betta food for kings.
21
Naftali go bi like animal wey dey free; di words wey e go tok, go dey good well-well.
22
Josef na betta vine wey dey produce good food; betta vine wey dem plant near wota and en branches dem dey klimb di wall.
23
Hunta go attack am, dem go shot and oppoz am.
24
But en bow go dey strong and e nor go move and e hand go sabi work bikos of Jakob God, di Shepad, wey bi di Rock for Israel,
25
una papa God wey go help una, di God wey get pawa wey go bless una with di blessing wey dey di sky for up; di Pesin wey get blessings wey dey wota and under di eart and even di ones from animals.
26
Una papa blessing dey great pass all di blessings wey dey from di mountins go rish di hills. Dis blessings go rest for Josef head, bikos e bi prince among en brodas.
27
Benjamin go bi like wolf wey dey skata en enemy. For morning, e dey distroy wetin e katch and for evening, e dey divide wetin e katch.”
28
Dis na di twelf tribes for Israel. Dis na wetin dia papa tell dem wen e dey bless dem. E bless all of dem as e suppose bless dem.
29
Den Jakob kommand sey, “I go soon die. So, make una beri mi with my papa dem for di grave wey dey Efron field for Hit land.
30
Na di grave wey dey Makpelah field for Mamre land for Kanaan, wey Abraham buy as burial groun from Efron wey bi Hit pesin.
31
Na der dem for beri Abraham and en wife Sarah; na der two dem for beri Isaak and en wife Rebekah and na der I for beri Leah.
32
Dem buy di field and di grave wey dey inside from Het shidren.”
33
Wen Jakob don kommand all en sons finish, e karry en leg well enter di bed, breath en last breath, den e kon die.
← Chapter 48
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 50 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50