bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 48
Genesis 48
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 47
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 49 →
1
Afta dis, dem kon tell Josef, “Yor papa nor dey strong again.” So e take en two sons, Manasseh and Efraim go meet am.
2
Wen dem tell Jakob sey, “Yor pikin Josef don kom meet yu,” e kon get up sidan for en bed.
3
Jakob tell Josef, “Di God wey get pawa appear to mi for Luz wey dey Kanaan land kon bless mi.
4
E tell mi sey, ‘I go make yu get shidren and propaty and dem go many well-well. I go make many nashons kom from yu and I go give dis land to yor shidren-shidren as dia own forever.’
5
Naw, koncerning yor two pikin wey yu born for Egypt before I kom here, dem go mi my own. Just as Efraim and Manasseh bi my own, na so Reuben and Simeon go bi my own too.
6
But any pikin wey yu go born afta dem, go bi yor own; wen dem won share di propaty for di promise land, dia name go dey under Manasseh and Efraim name.
7
But for mi, wen I dey kom back from Paddan, Rashel die kon make mi kry for Kanaan. E die for road, wen wi still dey far from Efratah. So I beri am for di road wey dem dey pass go Efrat (wey bi Betlehem naw).”
8
Wen Jakob si Josef sons, e kon ask, “Na who bi dis?”
9
Josef tell en papa, “Dem bi di pikin wey God don give mi for dis place.” En papa kon sey, “Bring dem kom meet mi, so dat I go bless dem.”
10
For dis time, Jakob nor dey si well again, bikos e don old well-well. So Josef take en sons near am well-well and en papa hold dem near en body kon kiss dem.
11
Israel tell Josef, “I nor bilive sey I go si yu again, but naw, God don let mi even si yor shidren too.”
12
So Josef take dem komot from Israel leg kon bow face groun.
13
Josef arrange dem; e use en rite hand take direct Efraim go Jakob left hand kon use en left hand direct Manasseh go Jakob rite hand. Den Josef take dem go meet en papa.
14
Israel take en rite hand put am on-top Efraim head, even doh na en bi di yonga one. As e cross en hand, e kon put di left hand on-top Manasseh head, but na Manasseh bi first-born.
15
Den Israel bless Josef kon sey, “Make di God wey yor grand-papa Abraham and Isaak serve; di God wey dey guide mi since thru-out my life kon rish today;
16
di Angel wey don protet mi from all wahala, bless dis boys. My name and my papa Abraham and Isaak name go shine for dia life. Dia shidren go many like san-san for dis eart.”
17
Wen Josef si sey en papa put en rite hand for Efraim head, e nor happy. So e try remove en papa rite hand from Efraim head go Manasseh head.
18
Josef tell en papa, “My papa, nor bi so, na Manasseh bi first-born, so make yu put yor rite hand for en head.”
19
But en papa sey, “My pikin, I know; I know wetin I dey do. Manasseh too go bi strong nashon and e go dey great. But even with all dis, en yonga broda go strong pass am and en shidren-shidren go many like san-san.”
20
So Israel bless dem dat day kon sey, “Na thru una Israel pipol go dey bless wen dem sey, ‘Make God bless us like Efraim and Manasseh.’ ”
21
Den Israel tell Josef, “Na die I dey so, but God go dey with yu and e go take yu go back to yor papa land.
22
Bikos yu dey higher dan yor brodas, I go give yu di low side for di mountin wey I take from Amor pipol with my swod and bow.”
← Chapter 47
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 49 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50