bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 50
Genesis 50
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 49
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
1
Den Josef kiss en papa for face kon kry well-well, bikos of am.
2
Josef kon tell di doctor sey make e dress di dead body, so di doctor kon dress Israel (wey bi Jakob).
3
E dress am well, so dat di body go fit dey der for forty day, bikos dat na di normal time wey di body suppose last. Egypt pipol use seventy days take mourn for am.
4
Wen dem don mourn finish, Josef kon tell Fero ofisas, “If really sey una like mi, make una tell Fero sey,
5
‘My papa make mi swear wen e sey, “I go soon die. Make yu beri mi for di grave wey I dig for mysef for Kanaan.” Naw make I go beri my papa; den I go kom back.’ ”
6
So Fero sey, “Make yu go beri yor papa, just as e make yu swear sey yu go do.”
7
So Josef go beri en papa and all Fero ofisas follow am go; from di senior ofisas go rish di oda ones for di hold Egypt,
8
Josef family, en brodas and en papa family. But dem leave di small-small shidren and dia animal for Goshen.
9
War horse and di driver still follow am go, so pipol wey follow am many well-well.
10
Wen dem rish Atad aria for di oda side for Jordan River, dem mourn and kry for der well-well. Na for der Josef for mourn seven days for en papa.
11
Wen Kanaan pipol wey dey stay di land si dem dey mourn for Atad, dem kon sey, “Wetin happen nor good at-all for Egypt pipol.” Dat na why dem dey koll di place Abel Mizraim and e dey afta Jordan River.
12
So Jakob shidren do for am, just as e kommand dem before.
13
En sons karry am go Kanaan kon beri am for di grave wey dey Makpelah field near Mamre. Dis na di field wey Abraham buy as burial groun from Efron wey bi Hit pesin.
14
Afta Josef don beri en papa, e kon go back to Egypt with en brodas and evribody wey follow am.
15
Wen Josef brodas si sey dia papa don die, dem kon sey, “Wot of if Josef still dey vex and e kon sey e go ponish us for evritin wey wi do am?”
16
So dem kon go tell Josef sey, “Yor papa give dis kommand before e die sey:
17
‘Make una tell Josef: “Make yu forgive yor brodas dia sins and di bad tins wey dem do yu.” ’ Naw make yu forgive di sins wey yor broda God savant, kommit.” Wen dem tell Josef di message, Josef kry well-well.
18
Den en brodas kom fall for en front dey sey, “Na wi bi dis and wi bi yor savants.”
19
But Josef ansa dem, “Make una nor fear. Na God know wetin E won do.
20
Even doh una mind na to kill mi, but God let am bi like dat, make betta tins for happen, so dat many pipol go dey save as una dey si today so.
21
So, make una nor fear. Evritin wey una wont, I go give una and una shidren and family.” Den e follow dem tok well.
22
Josef stay for Egypt with en papa family. Josef stay for one hundred and ten years.
23
Josef si Efraim shidren-shidren. E still si Manasseh pikin Makir and en shidren; Josef give dem betta land and propaty.
24
Den Josef tell en brodas, “Na die I dey so. But God go true-true kom meet and take una go di land wey E promise sey E go give Abraham, Isaak and Jakob.”
25
Josef kon make Israel pipol swear. E tell dem, “God go really kom meet una. Den una must karry my bones follow body komot from dis place.”
26
So Josef die wen e bi one hundred and ten years. Afta dem don dress en body dem kon put am for one koffin for Egypt.
← Chapter 49
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
Recommended Reading
Commentary
Genesis Commentaries
→
Devotional
Genesis Devotional Guide
→
Get This Bible
Nigerian Pidgin Bible Study Bible
→