bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 40
Genesis 40
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 39
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 41 →
1
Afta all dis tins don happen, di pesin wey dey serve wine for Egypt king and di pesin wey dey bake en bread kon make am vex.
2
Fero wey bi king, vex well-well for en two ofisas
3
so e kon arrest dem put for prison for di bodyguard oga house where dem put Josef too.
4
Di oga for di guards kon choose Josef as di pesin wey go dey serve di two ofisas for prison. Dem stay for prison tey small.
5
One day, di two of dem; both di pesin wey dey serve wine and di baker for Egypt wey dey prison kon dream. Each of dem dream get en own meaning.
6
Wen Josef meet dem for morning, e si sey dia face nor dey okay.
7
So e ask Fero ofisas wey dey prison with am for en masta house, “Wetin make una face bi like dis today?”
8
Dem ansa, “Wi dream one kind bad dream, but e nor get anybody wey fit tell us wetin di dreams mean.” Josef ansa, “Nor bi God dey tell pipol wetin dreams mean? Make una tell mi di dream.”
9
So di one wey dey serve wine kon tell Josef en dream: “Inside my dream, e get one vine for my front.
10
Di vine get tree branches. Di vine kon dey grow dey fine and e kon dey produce ripe-ripe grape.
11
Fero cup dey my hand, so I take di grape kon press am put for di cup den give di cup to Fero.”
12
Den Josef tell am, “Na wetin yor dream mean bi dis: di three branches na three days.
13
For three days time, Fero go karry yu go back to yor ofis and yu go dey serve wine for Fero as yu dey do before.
14
But make yu remember mi wen evritin dey okay with yu and make yu menshon mi to Fero wen di time rish, so dat I go komot from dis prison.
15
Bikos dem buy mi kom from Hibru land and for der, I nor do anytin wey make dem put mi for gutta.”
16
Wen di man wey dey bake bread si sey di meaning dey good, e kon tell Josef, “I still dream too: three kake basket dey my head,
17
and for di one wey dey top, difren kind food wey dem bake for Fero dey inside, but di birds dey chop am from di basket wey dey my head.”
18
So Josef ansa, “Na wetin yor dream mean bi dis: di three basket na three days.
19
For three days time, Fero go sey make dem hang yu for tree. Den birds go kom chop yor flesh.”
20
So e happen sey for di third day, wey bi Fero birtday, e kon do party for all en savants and e sey make dem release both di man wey dey serve am wine and di one wey dey bake.
21
Di one wey dey serve wine, Fero gi-am en work back.
22
But e hang di baker, just as Josef tell dem before.
23
But di man wey dey serve wine nor remember Josef again and e kon forget am.
← Chapter 39
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 41 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50