bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 46
Genesis 46
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 45
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 47 →
1
So Israel kon start en journey and e karry evritin wey e get follow body. Wen e rish Beersheba, e offa sakrifice give en papa Isaak, God.
2
Wen Israel dey sleep for nite, God kon tok to am for vishon sey, “Jakob, Jakob!” E ansa, “Na mi bi dis!”
3
God sey, “Na mi bi God, di God wey yor papa serve. Make yu nor fear to go Egypt, bikos na der I go for make yu bi one strong nashon.
4
I go follow yu go Egypt and na mi go take my hand bring yu kom back to dis land. Josef go kare for yu till yu die for Egypt.”
5
Den Jakob komot from Beersheba and Israel sons put dia papa, dia shidren and dia wifes for di horse wey Fero send kom kon karry dem go Egypt.
6
Jakob and all en shidren karry dia animals and propaty wey dem get for Kanaan kon go Egypt.
7
Jakob karry en sons and grand sons, en dota and grand dotas and evritin wey e get, enter Egypt.
8
Dis na di name of Israel shidren wey follow am go Egypt, dat is Jakob and en sons: Reuben, Jakob first-born
9
Reuben sons na: Hanok, Pallu, Hezron and Karmi.
10
Simeon sons na: Jemuel, Jamin, Ohad, Jakin, Zohar and Shaul (di pikin wey one Kanaan woman born for am).
11
Levi sons na: Gershon, Kohat and Merari.
12
Judah sons na: Er, Onan, Shelah, Perez and Zera (But Er and Onan die for Kanaan land). Perez sons na Hezron and Hamul.
13
Issakar sons na: Tola, Puah, Jashub and Shimron.
14
Zebulun sons na: Sered, Elon and Jahleel.
15
All dis na di shidren wey Leah born for Jakob for Paddan Aram, with Dinah en dota. All en sons and dotas na thirty-three.
16
Gad sons na: Zifion, Haggi, Shuni, Ezbon, Eri, Arodi and Areli.
17
Asher sons na: Imnah, Ishvah, Ishvi, Beraya and Serah wey bi dia sista. Beraya sons na Heba and Malkiel.
18
All dis na di shidren wey Leah savant, Zilpah born. E born dem for Jakob and all of dem na sixteen.
19
Jakob wife Rashel born only: Josef and Benjamin.
20
Dem born Manasseh and Efraim give Josef for Egypt. Potifara wey bi priest for On, na en dota Asenat born dem for Josef.
21
Benjamin sons na: Bela, Beka, Ashbel, Gera, Naaman, Ehi, Rosh, Muppim, Huppim and Ard.
22
All dis na Rashel sons wey dem born give Jakob and dem bi fourteen.
23
Dan son na: Hushim.
24
Naftali sons na: Jahziel, Guni. Jeza and Shillem.
25
Dis na di shidren wey Rashel savant, Bilhah born. E born all of dem for Jakob and dem bi seven.
26
All Jakob main shidren wey follow am go Egypt, na sixty-six dem bi. (Jakob shidren wife dem nor dey join dis nomba.)
27
If wi kount di two sons wey dem born give Josef for Egypt, all di pipol wey Josef get for Egypt kon bi seventy.
28
Jakob kon send Judah for front go tell Josef make e kon follow am go Goshen. So dem kon rish Goshen land.
29
Josef klimb en shariot kon go meet en papa Israel, for Goshen. Wen e meet am, e hug am kon bigin kry.
30
Israel kon tell Josef, “As long as I don si yor face kon know sey yu dey alive, I fit die naw.”
31
Den Josef tell en brodas and evribody wey dey en papa house sey, “I go-go tell Fero sey, ‘My brodas and my papa family wey bin dey for Kanaan, don kom follow mi stay.
32
Di men sabi guide animal; dem dey kare for animals well-well. Dem kom with dia animals, plants and evritin wey dem get.’
33
Wen Fero koll and ask una sey, ‘Na wetin una dey do?’
34
Den make una tell am sey, ‘Yor savants dey kare for animals since wi bi small pikin kon rish naw, both wi and awa papa.’ Make una tok like dat, so dat una go fit stay for Goshen land, bikos Egypt pipol nor like pipol wey dey kare for animals.”
← Chapter 45
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 47 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50