bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 15
Genesis 15
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 16 →
1
Afta all dis tins, God tok to Abram for vishon: “Abram! Make yu nor fear! Na mi dey guide yu and yor reward go big well-well.”
2
But Abram sey, “My Oga God wey get pawa, wetin Yu go give mi, since I neva born pikin and na dis Elieza for Damaskus go inherit my propaty?”
3
Abram still sey, “Since Yu neva give mi shidren, den one of my savants go inherit my propaty!”
4
But God sey: “Yor savant nor go inherit yor propaty, but na yor own pikin wey go kom from yor blood.”
5
God take am go outside kon sey, “Look di sky and yu go si di stars, den try if yu fit kount dem!” Den God sey, “Na as di stars bi for up, na so yor shidren go plenty rish.”
6
Abram bilive God and bikos of en strong faith, God kon koll am raitious man.
7
God tell am, “Na mi bi di Oga God wey bring yu kom from Ur for Kaldea, so dat I go give yu all dis land as yor own.”
8
But Abram sey, “My Oga God wey get pawa, na wetin go bi di sign to show sey I go get all dis land?”
9
God ansa, “Make yu bring one melu, one goat and one ram; make all of dem bi three years, den take one dove and one yong pijin follow body.”
10
So Abram take all of dem go gi-am kon kut dem into two, den e put di two side face each oda, but e nor kut di birds.
11
Wen birds for sky won kon chop di tins wey Abram kill so, e kon porshu all of dem komot.
12
Wen nite rish, Abram kon sleep deep sleep, den fear kon dey katch am.
13
So God tell Abram sey, “Make yu know naw sey yor shidren go bi strenjas for anoda man land. Dem go ponish and trit dem like slave for four hundred years.
14
But I go judge di kountry wey go ponish dem. Afta evritin, dem go kom out with plenty propaty.
15
But for yu, wen yu don old well-well, yu go die with peace of mind kon go join yor grand-grand papa dem.
16
For di fourt generashon, yor shidren go kom back to dis place, bikos Amor pipol sin neva plenty rish.”
17
Wen evening rish and day don dark, one pot wey dey bring smoke with fire and dey shine like tosh kon pass between di animals wey Abram sakrifice.
18
Dat day, God kon make kovenant with Abram sey: “From Egypt borda go rish Eufrates River, I promise to give all dis land to yor shidren,
19
plus Kenite, Kenizz, Kadmon,
20
Hit, Periz, Refah,
21
Amor, Kanaan, Girgash and Jebus pipol land.”
← Chapter 14
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 16 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50
Recommended Reading
Commentary
Genesis Commentaries
→
Devotional
Genesis Devotional Guide
→
Get This Bible
Nigerian Pidgin Bible Study Bible
→