bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 45
Genesis 45
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 44
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 46 →
1
Josef nor fit kontrol ensef again so e kon sey, “Make evribody komot for my front naw!” Nobody dey der with Josef wen e tell en brodas who e bi.
2
E kry well-well; Egypt pipol and evribody plus Fero sef, hear about wetin happen.
3
Josef kon tell en brodas, “I bi Josef! My papa still dey alive?” En brodas nor fit ansa am, bikos dem sopraiz well-well with fear as dem stand for en front.
4
Josef kon tell dem, “Make una waka near mi,” so dem waka near am. Den e sey, “I bi Josef una broda wey una sell give pipol wey dey kom Egypt.
5
Naw, make una nor fear or dey vex with unasef, bikos even doh una sell mi kom here, na God send mi go for una front, so dat pipol life go dey save!
6
Bikos for dis two years wey honga dey so, na so honga go still dey for di next five years.
7
So God send mi kom for una front, so dat una go dey di eart and una nor go die.
8
So naw, nor bi una send mi kom here, but na God. E don turn mi to Fero adviser, di oga ova all en propaty and di ruler for Egypt land.
9
“Naw, make una kwik-kwik go tell my papa sey, ‘Dis na wetin Josef yor pikin tok: “God don make mi oga ova all di land for Egypt. So make yu kwik-kwik kom meet mi!
10
Una go dey for Goshen land and una go dey near mi; both una, una shidren, una grand-shidren, una animals and plants and evritin wey una get.
11
I go provide food for una for here, bikos dis honga go still last for five years. If not, una go soon dey poor; both una and una family and evribody and tins wey bilong to una.” ’
12
“Una with my broda Benjamin don si sey na mi, Josef, dey follow una dey tok.
13
So make una tell my papa about all my honor for Egypt and about evritin wey una dey si so. But make una kwik bring my papa kom meet mi for here!”
14
Den Josef hold en broda Benjamin near body kon kry well-well and Benjamin kon dey kry too.
15
Josef kiss all en brodas as e dey kry. Afta, en brodas kon follow am tok.
16
Naw dem kon go tell Fero for en house sey, “Josef brodas don kom.” Di news sweet Fero and en savants.
17
Fero kon tell Josef, “Make yu go tell yor brodas sey, ‘Make una do like dis: Make una load una animal kon go Kanaan land!
18
Den make una karry una papa and family kom stay here! Den I go give una di best land for Egypt and una go dey chop di best food for dis land.’
19
Make yu still tell dem sey, ‘Make una do like dis: Una go karry horse wey dey karry load from dis land kon go karry una family kom from Kanaan; both una wifes and shidren. Make una bring una papa kom too.
20
Make una nor worry about una propaty, bikos di best tins wey dey Egypt go bi una own.’ ”
21
So Israel sons kon do as Josef tell dem. Josef give dem horse wey dey karry load, just as Fero tok kon give dem tins wey dem go nid for dia journey.
22
E still give all of dem many klot, but e give Benjamin three hundred silva and five klot.
23
E send dis tins go meet en papa: ten donkey wey karry di best goods for Egypt and ten woman donkey wey karry korn, food and di tins wey en papa go nid for en journey.
24
Den e send en brodas go and dem kon komot from en present. E tell dem, “As una dey travel, make una nor let fear worry una.”
25
So dem komot from Egypt go meet dia papa, Jakob for Kanaan.
26
Dem tell dia papa, “Josef neva die and na en dey rule Egypt!” Jakob kon sopraiz, bikos e nor bilive dem.
27
But wen dem tell Jakob evritin wey Josef tell dem and wen e si di horse wey Josef send kom karry am, e kon bilive sey na trut.
28
Den Israel sey, “E don do! My pikin Josef still dey alive! I go-go si am before I die.”
← Chapter 44
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 46 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50