bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 28
Genesis 28
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 27
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 29 →
1
So Isaak koll Jakob kon bless am. Den e kommand am sey, “Make yu nor marry any Kanaan woman!
2
Make yu dey go Paddan Aram naw-naw! Make yu go Betuel house wey bi yor mama papa kon find wife for der among yor mama broda Laban dotas.
3
God wey get pawa well-well go always bless yu! E go make yu dey fruitful kon give yu plenty shidren! Den yu go bi very big nashon.
4
E go give yu and yor shidren-shidren di blessing wey E give Abraham, so dat una go take di land wey God give Abraham; di land wey yu just dey stay as strenjas.”
5
So Isaak send Jakob go and e go Paddan Aram go meet Betuel pikin Laban, di Aramean wey bi en mama Rebekah, broda.
6
Esau si sey Isaak don bless Jakob kon send am go Paddan Aram, so dat e go get wife for der. As Isaak dey bless am, e kommand am, “Make yu nor marry Kanaan woman.”
7
Jakob obey en papa and mama kon go Paddan Aram.
8
Na den Esau kon know sey en papa nor like di wimen from Kanaan.
9
So Esau go Ishmael kon marry Mahalat wey bi Nebaiot sista and na Ishmael, Abraham pikin born am. E marry dis one join di wifes wey e get before.
10
But Jakob komot Beersheba kon go Haran.
11
E rish one place where e stay small, bikos evening don dey rish. E take one among di stones kon put am near en head. Den sleep kon katch am for dat place
12
and e kon dream. E si one strait road wey from eart go rish heaven and God angels dey waka up-and-down for di road,
13
den Oga God stand for di top. God kon sey, “Na mi bi di Oga God, yor grand-papa Abraham and yor papa Isaak God. Dis groun wey yu sleep put so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren.
14
Yor shidren-shidren go plenty like san-san for groun and dem go skata go west, east, nort and sout. I go bless all di family for di world with yu and shidren-shidren name.
15
I go dey with yu! I go guide yu for anywhere wey yu dey go kon bring yu kom back to dis land. I nor go leave yu until I don do wetin I promise yu!”
16
Den Jakob wake-up kon sey, “True-true, God dey dis place and I nor know!”
17
Bikos e dey fear, e kon sey, “Wish kind wonderful place bi dis! Dis nor bi any oda place, but na God house! Dis na heaven gate!”
18
Very early for di next morning, Jakob take di stone wey e put near en head kon keep am as holy stone. Den e pour oil on-top am.
19
E koll di place Bethel, even doh di name before na Luz.
20
Den Jakob promise sey, “If God dey with mi kon guide mi thru dis journey wey I dey do so and E give mi food make I chop with klot to wear
21
and I go back to my papa house sey nor-tin do mi, den di Oga God go bi my God.
22
Den dis stone wey I dey keep der as holy stone, go bi God house and I go make sure sey I give Yu back one out of evry ten tin wey Yu give mi.”
← Chapter 27
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 29 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50