bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 2
Genesis 2
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 1
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 3 →
1
God kon kreate evritin wey dey di heaven and di eart finish.
2
For di sevent day, God finish di work wey E dey do and E kon rest.
3
God bless di sevent day kon make am holy, bikos na dat day E stop all di work wey E dey do since.
4
Dis na di story about di heaven and eart wey God kreate.
5
For dis time, nor-tin don ever grow for di eart, bikos Oga God neva let rain fall and nobody dey wey go klear di groun or plant put.
6
But wota dey flow from di sea kon wet di groun.
7
So Oga God take some san-san for groun take mold man kon breath life enter en nose, den di man kon dey breath.
8
God make Eden Gardin for di east kon put di man wey E kreate for der.
9
God kon make difren trees make dem grow for di soil and dem dey good for food. (Naw, di tree wey get life, wey dey make pesin know tins well-well; wey dey good and bad, dey for di gardin centre.)
10
So as wota dey flow from Eden go wota di gardin, e dey from der, divide into four river.
11
Di first river name na Pishon; e dey flow for Havilah land, di place where gold dey.
12
(Di gold wey dey di land, dey pure and difren-difren good iron still dey der too.)
13
Di sekond river name na Gihon; e dey flow pass Kush land.
14
Di third river name na Tigris; e dey flow pass di east for Assyria. And di fourt one name, na Eufrates.
15
God take man kon put am for Eden Gardin, so dat e go kare for evritin.
16
Den Oga God kommand di man sey, “Yu fit chop from evry tree wey dey di gardin,
17
but make yu nor chop from di tree wey get life; wey dey make pesin know tins; di tree wey dey good and bad, bikos wen ever yu chop from am, na dat day, yu go die.”
18
Den God kon sey, “E nor good make only man dey. I go gi-am somebody wey go make belle sweet am.”
19
God make evritin wey get life from di groun. E bring dem kom meet di man make e give dem name and any name wey di man koll any animal, na dat name go follow am.
20
So man name all di animals, birds for di sky and evritin wey get life for di eart, but Adam nor si anytin wey bi like am.
21
So Oga God kon make man sleep deep sleep and as e dey sleep, God take one from di man rib kon use flesh kover di place.
22
Den Oga God make anoda pesin from di rib wey E take from di man, den E bring am kom meet di man.
23
Den di man sey, “At last, dis one bone kom from my bone and en flesh kom from my flesh; I go koll am, ‘Woman,’ bikos God make am from man.”
24
Dat na di rizin why man must live en papa and mama kon go stay with en wife and dem two go bikom one.
25
Di man and en wife nor wear anytin for body, but shame nor katch dem at-all.
← Chapter 1
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 3 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50