bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 32
Genesis 32
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 31
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 33 →
1
Jakob kon go en own way and God angels kom meet am.
2
Wen Jakob si dem, e kon sey, “God dey for dis place!” So e name di place Mahanaim.
3
Jakob send message go meet en broda Esau for Seir wey dey for Edom land
4
and e tell dem sey, “Make una tell my oga Esau sey: Dis na wetin yor savant Jakob tok, ‘I don dey stay with Laban since kon rish naw.
5
I get difren animals, man and woman savants. I just sey make I kon tell my oga, so dat e go forgive mi.’ ”
6
Leta, di messenja kom back kon tell Jakob sey, “Wi go meet yor broda Esau and E dey kom meet yu and 400 men dey with am.”
7
Den Jakob kon dey fear and en mind nor setol. E divide both di pipol wey dey with am and di animals into two group,
8
bikos e tink sey, “If Esau kom attack one group, den di oda group for di oda side go run.”
9
Jakob kon sey, “My papa Abraham and Isaak God, di Oga God wey tell mi sey, ‘Make yu go back to yor kountry and yor family, so dat I go do good for yu,’
10
I nor deserve all di good tins and kindness wey Yu don show mi, yor savant, bikos na with only my rod I take cross Jordan River, but naw, I don divide my family and propaty into two.
11
Abeg, make Yu save mi from Esau my broda; bikos I dey fear sey e fit kom attack mi, my wifes and my shidren.
12
Yu bin sey, ‘I go really do good for yu kon make yor shidren plenty like san-san wey nobody fit kount.’ ”
13
So Jakob stay der dat nite and from all di tins wey e get, e kon send some present go give en broda Esau.
14
Di present na two hundred woman goat, twenty man goat, two hundred iyu, twenty ram,
15
thirty kamel wey get betta milk for breast and dia shidren, forty melu and ten bull, twenty woman donkey and ten man donkey.
16
E pak dem give en savants and dem separate dem, den e sey, “Make una dey go for front and make una make sure sey dem nor join togeda.”
17
E tell di savant wey dey front-front sey, “Wen my broda Esau meet and ask yu sey, ‘Na who bi yor oga? Where yu from dey kom? Who get all dis animal wey yu dey guide?’
18
Den make yu sey, ‘Dem bi yor savant Jakob own. E send dem as gift kon give yu, Esau awa oga. Jakob sef dey kom for awa back.’ ”
19
E still kommand di sekond one with all di oda savants for en front wey dey follow di gifts sey, “All of una must tell my broda Esau di same tin wen una meet am.
20
Una must sey, ‘Yor savant Jakob dey kom for back.’ ” Jakob tink for en mind sey, “I go first beg am with di gifts wey I dey send go for front. Afta dat one, I go meet am, den may bi e go fit forgive mi.”
21
So e send di gifts go for front, while e kon sleep for en kamp dat nite.
22
For nite, Jakob kwik-kwik take en two wife, en two savant and en eleven shidren kon go Jabbok wotaside.
23
E take dem cross di wota with all di tins wey e get.
24
So na only Jakob kon dey. Den en and one man fight till day break.
25
Wen di man si sey e nor fit beat Jakob, e kon shift di bone for Jakob lap komot from where e dey.
26
Den di man sey, “Make yu allow mi dey go, bikos day don dey break.” But Jakob ansa, “I nor go let yu go, unless yu bless mi.”
27
Den di man ask Jakob, “Wetin bi yor name?” Jakob ansa, “My name na Jakob.”
28
Den di man sey, “Dem nor go koll yu Jakob again, but from today go, na Israel dem go dey koll yu, bikos yu don fight with God and man and yu don win.”
29
Den Jakob ask am, “Abeg make yu tell mi yor name.” But di man sey, “Why yu dey ask for my name?” So e kon bless am.
30
So Jakob koll di place Penuel, kon sey, “I don si God face-to-face and I still dey alive.”
31
E nor fit waka well as e dey pass Penuel land, bikos of en lap wey dey pain am, so sun kon dey beat am.
32
Dat na why till today, Israel pipol nor dey chop di meat wey dey lap, bikos di man tosh Jakob lap.
← Chapter 31
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 33 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50