bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 44
Genesis 44
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 43
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 45 →
1
Josef kon tell di savant wey dey kare for en house sey, “Make yu pak food full dia sak kon give evribody dia money back.
2
Den make yu put my silva cup for di yonga one sak, plus en money.” So di man do as Josef tell am.
3
Wen morning rish, di men and dia donkey kon go.
4
Dem neva go far from di town wen Josef tell di savant wey dey kare for en house, “Make yu porshu dem at wons! Wen yu katch dem, tell dem sey, ‘Wetin make una repay bad for good?
5
Wetin make una tif my oga silva cup wey e dey use drink and shek di future? Una don do bad!’ ”
6
Wen di savant katch dem, e kon tell dem di word.
7
Dem ansa di savant, “Wetin make awa oga tok like dis? E nor dey possibol for yor savant to do dat kind tin!
8
Si! Di money wey wi si for awa sak before, wi bring am kom back. So wetin go make us tif silva or gold from yor oga house?
9
If any of us tif am, e go die and di remainin of us go bi awa oga savant!”
10
Di savant ansa, “Una don choose una own ponishment! Di pesin wey tif am go bi my savant, but di rest of una go-go free.”
11
So dem put dia sak for groun kon open am.
12
Den di man bigin shek. E start with di old one first till e rish di last one. Dem kon si di cup for Benjamin sak!
13
Den all of dem kon tear dia klot! Den dem arrange dia donkey kon go back to di town.
14
So Judah and en brodas kon go back to Josef house. Josef still dey house, so dem kon fall dey beg am.
15
Josef tell dem, “Wetin una tink sey una do so? So una nor know sey pesin like mi dey know tins before e happen?”
16
Judah ansa, “My oga, wetin wi go fit tell yu? Wetin wi go fit tok? How wi go fit take free awasef? God don espose awa sin! My oga, wi don bi yor savant, wi and di pesin wey dem si di cup for en sak.”
17
But Josef tell dem, “I nor go fit do dat tin! Di man wey dem for si di cup for en hand go bi my savant and di rest of una fit go meet una papa with peace.”
18
Den Judah ansa Josef, “My oga, abeg make yu let yor savant tok to yu. Abeg make yu nor vex with yor savant, bikos yu just bi like Fero.
19
My oga ask en savants sey, ‘Una still get papa or broda?’
20
Wi ansa sey, ‘Awa papa don old and wi get one small broda wey dem born for awa papa wen e don old. Di boy broda don die. Na only en bi en mama pikin wey remain and en papa love am well-well.’
21
Den yu tell us yor savants sey, ‘Make una go bring am kom make I si am.’
22
Wi tell awa oga sey, ‘Di boy nor go fit leave en papa. If e leave en papa, di papa go die.’
23
But yu tell yor savants sey, ‘If una yonga broda nor follow una kom, una nor go si my face again.’
24
Wen wi go meet awa papa, wi tell am evritin wey awa oga tok.
25
Den awa papa sey, ‘Make una go buy some food kom.’
26
But wi tell am, ‘Wi nor go fit go, unless awa yonga broda go follow us, bikos wi nor go fit si di man if e nor follow us.’
27
Den yor savant, awa papa kon sey, ‘Una know sey my wife born two boys for mi.
28
Di first boy disappear and I kon sey, “Wiked animal go don chop am to pieces.” I neva si am since den.
29
If una take dis one from mi too and sometin happen to am, den una go make mi die for pain and shame.’
30
“So naw, how wi won take go back to yor savant, awa papa and di boy nor dey with us; bikos en life dey inside dis en pikin life.
31
Wen e si sey di boy nor dey with us, e go die and yor savant go let awa papa yor savant die inside pain and shame.
32
True-true, yor savant kon tell en papa sey, ‘If I nor bring di boy kom back, den for di rest of my life, I go dey bear di blame.’
33
So naw, make yu allow mi bi yor slave instead of dis boy. But for di boy, make e follow my brodas go back.
34
How I won take go back go tell my papa, if di boy nor dey with mi? I nor go fit bear to si my papa sofa for pain.”
← Chapter 43
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 45 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50