bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 39
Genesis 39
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 38
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 40 →
1
Naw, dem kon take Josef kom Egypt and Potifa, one Fero offisa and di bodyguard oga for Egypt kon buy Josef from Ishmael pipol wey bring am kom der.
2
God dey with Josef and evritin dey betta for am, even as e dey for en Egypt oga house.
3
En oga kon si sey God dey with am and God dey make evritin wey Josef do, betta.
4
Potifa kon like Josef well-well as Josef dey serve am, so e make am oga ova all di savants for en house and evritin wey e get.
5
From dat time, Potifa make Josef as pesin wey go dey kare for evritin wey dey en house and God kon dey bless Potifa house. Bikos of Josef, God blessing dey for evritin wey e get, both for di house and for di field.
6
So Potifa leave evritin wey e get for Josef make e kare for dem. So di only tin wey koncern Potifa for di house, na to chop. Josef fine well-well and e get betta karata.
7
Afta sometaim, en oga wife kon dey like am, den di woman tell am, “Make yu kom sleep with mi.”
8
But Josef nor gri and e sey, “Si, bikos of mi, my oga nor even dey borda shek anytin for di house again and e don make mi dey kontrol evritin wey e get.
9
Na mi big pass for dis house and my oga don give mi evritin escept yu, bikos yu bi en wife. So wetin go make mi do dis kind wikedness kon sin against God?”
10
As di woman dey tok to Josef evriday sey make e sleep with am or stay small with am, Josef nor dey listin to am.
11
But one day wen Josef enter inside di house go do en work and all di oda savants nor dey inside di house,
12
di woman kon hold en klot dey sey, “Make yu sleep with mi.” But e run komot di house kon leave en klot for di woman hand.
13
Wen di woman si sey Josef don leave en klot for en hand run komot from di house,
14
e kon koll di men for di house dey sey, “Si, my husband don bring one Hibru pesin make e kom take us do yeye. Josef won kon sleep with mi naim I shaut well-well.
15
As Josef know sey I dey shaut and kry, e kon run komot di house, but e forget sey en klot dey near mi.”
16
So di woman keep di klot until en husband kom,
17
den e tell am di same story sey, “Di Hibru savant wey yu bring kom dis house, waka enter my room won kon take mi do yeye.
18
But as soon as I bigin shaut dey kry, e kon run komot di house and e leave en klot.”
19
As di oga hear di word wey en wife tell am sey, “Dis na how yor savant trit mi,” e kon dey vex for Josef.
20
So Josef oga karry Josef go put for prison. Na only pipol wey di king arrest dey-dey for di prison where dem karry Josef go.
21
But God dey with Josef kon show am as E love am rish and E make di pesin wey dey guide di prison, love Josef well-well too.
22
So di pesin wey dey guide di prison put all di prisonas for Josef kare. Na Josef bi oga for evritin wey dem dey do.
23
Di pesin wey dey guide di prison nor kare about anytin wey dem sey make Josef do or look afta, bikos God dey with Josef. Anytin wey e do, God dey make am susid.
← Chapter 38
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 40 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50