bible
ra
🌐 Language
English
Español
Français
Deutsch
Português
Italiano
Nederlands
Русский
中文
日本語
한국어
العربية
Türkçe
Tiếng Việt
ไทย
Indonesia
All Languages
Home
/
Nigerian
/
Nigerian Pidgin Bible
/
Genesis 17
Genesis 17
Nigerian Pidgin Bible
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 18 →
1
Wen Abram na ninty-nine years, God appear to am kon sey, “Na mi bi di Oga God wey get pawa. Follow mi waka and nor-tin go do yu.
2
I go make my kovenant with yu kon give yu plenty shidren.”
3
Abram bow face groun and God tok to am,
4
“I make dis kovenant with yu: I promise sey yu go bi many pipol papa.
5
Yor name nor go bi Abram again, but e go bi Abraham, bikos I dey make yu papa for many nashons.
6
I go give yu many shidren and some of dem go bi kings. Yu go get many shidren and dem go get kountries.
7
“I go keep my promise wey I make with yu and to yor shidren-shidren, di kovenant go always dey forever. I go bi yu and yor shidren God.
8
I go give yu and yor shidren dis land where yu dey stay as strenja naw. Di whole Kanaan land go bi yor shidren-shidren own forever and I go bi dia God.”
9
God still tell Abraham, “Yu too must gri sey yu go keep di promise wey yu make with mi, both yu and yor shidren-shidren.
10
Yu and yor shidren-shidren must agri to sekonsaiz evry boy pikin among una.
11
From naw go, yu must sekonsaiz evry pikin wey bi boy, eight days afta dem born am,
12
plus yor savant wey bi strenja shidren wey dem go born for here. Dis go show sey mi and yu, get kovenant.
13
Una must sekonsaiz evry pikin and dis go bi sign to show sey my kovenant with yu, go bi forever.
14
Anybody wey dem neva sekonsaiz, I nor go koll am my own, bikos e neva keep di kovenant with mi.”
15
God tell Abraham, “Make yu nor koll yor wife Sarai again; from naw go, en name na Sarah.
16
I go bless am and I go make am born boy for yu. I go bless am and Sarah go bi plenty pipol mama and kings go dey among en shidren-shidren.”
17
Abraham bow take face tosh groun, but e bigin laf wen e tink for en mind dey sey, “Man go fit born pikin wen e don rish hundred years? Abi Sarah fit born pikin naw wey e bi ninty?”
18
Abraham kon ask God, “Why Yu nor allow Ishmael to bi my only pikin?”
19
But God sey, “No! Yor wife Sarah go get belle kon born boy for yu and yu go koll am, Isaak. I go keep my kovenant with am and en shidren-shidren forever. Di kovenant na forever and ever.
20
I hear wetin yu tok about Ishmael. I go bless am kon gi-am many shidren. E go bi twelf prince papa and I go make en shidren-shidren great.
21
But I go keep my kovenant with yor pikin Isaak, wey Sarah go born for dis time next year.”
22
Wen God tok to Abraham finish, E kon leave am.
23
For dat same day, Abraham obey God kon sekonsaiz en pikin Ishmael and all di oda boys wey dey en house, plus en savants pikin and doz wey dey with am.
24
Abraham na ninty-nine years wen dem sekonsaiz am
25
and en son Ishmael na thirteen.
26
Na di same day dem take sekonsaiz Abraham, Ishmael
27
and all en savants.
← Chapter 16
Jump to:
Chapter 1
Chapter 2
Chapter 3
Chapter 4
Chapter 5
Chapter 6
Chapter 7
Chapter 8
Chapter 9
Chapter 10
Chapter 11
Chapter 12
Chapter 13
Chapter 14
Chapter 15
Chapter 16
Chapter 17
Chapter 18
Chapter 19
Chapter 20
Chapter 21
Chapter 22
Chapter 23
Chapter 24
Chapter 25
Chapter 26
Chapter 27
Chapter 28
Chapter 29
Chapter 30
Chapter 31
Chapter 32
Chapter 33
Chapter 34
Chapter 35
Chapter 36
Chapter 37
Chapter 38
Chapter 39
Chapter 40
Chapter 41
Chapter 42
Chapter 43
Chapter 44
Chapter 45
Chapter 46
Chapter 47
Chapter 48
Chapter 49
Chapter 50
Chapter 18 →
All chapters:
1
2
3
4
5
6
7
8
9
10
11
12
13
14
15
16
17
18
19
20
21
22
23
24
25
26
27
28
29
30
31
32
33
34
35
36
37
38
39
40
41
42
43
44
45
46
47
48
49
50